Xenophobia: South Africa High Commissioner to Nigeria say na 'jaguda pipo' dey attack foreigners

Di South Africa High Commissioner to Nigeria Bobby Moore don deny say na xenophobic attacks dey happun for im kontri.
According to am, na jaguda pipo plus thieves dem dey cause di current kasala and kili-kili against Nigerians and oda foreign nationals for dia kontri
E say so far, di authority don arrest 70 pipo and go kontinu to do more to ensure say dem stop di violence and stealing wey di happun.
Oga Moore tok afta Nigeria Minister of Foreign Affairs Geoffrey Onyeama summon am today over di recent attacks against Nigerians for dia kontri.
For dia, Nigeria goment demand compensation from South Africa for all Nigerians wey dey affected by di recent attacks for South Africa.
Onyeama say di killi-Killi of Nigerians don too much and di South African must hold dia pipo accountable and compensate Nigerians wey dey affected for dis new wave of attacks.
Oga Onyeama say dis attacks on Nigeria na sake of say di South African authorities dey delay di signing of one ogbonge proposal wey Nigerian goment bin draft since 2015, as part of measure to address di situation.

Wia dis foto come from, Getty Images
For 2015, di Nigerian goment bin draft one MOU wey dem call early warning mechanism to epp both di South African authorities and Nigeria work togeda to draft framework wey dem fit stop di attack, but since den, nothing don happun.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di Nigerian goment also want di South African goment to allow Nigerian police to work wit dia police as well as allow dem attached to the di Kontri's mission do as to epp share intelligence on top crime either committed by Nigerians or against Nigerians.
But oga Moore explain say di reason dem dey delay to sign di MOU na say dia goment bin dey meet wit lawyers first to chook eye for di proposal before dem sign am.
E say so far, di authority don arrest 70 pipo and go kontinu to do more to ensure say dem stop di violence and stealing wey di happun.

Wia dis foto come from, MARCO LONGARI
Meanwhile, di High Commissioner of Nigeria for South Africa don tell Nigerians wey dey SA to remain calm.
Ambassador Kabiru Bala say di High Commission and di Consulate for Pretoria and Johannesburg dey compile di list of all Nigerians wey be victims of di current attacks to engage South Africa and oda stakeholders for support. Im add say make Nigerian victims of di current incident come forward to report dia situation to di High Commission an ddi Consulate.
Inside statement Bala sign, im say " Di two missions go continue to be home for all Nigerians in dis trying times and in di future." Bala also add say "Di two Missions dey work with authorities for South Africa including police to adress di unfortunate incident.
Di latest developments dey come afta Nigerians para ontop tori of di latest attacks of dia kontri pipo for South Africa.










