8th National Assembly don end dia watch

Wia dis foto come from, @nass
- Author, Dooshima Abu
- Role, BBC News Pidgin, Abuja
- Read am in 5 mins
Afta four long years, di watch of di men and women for Nigeria National Assembly don end afta dem do dia last sitting on Thursday.
Lawmakers for Abuja for valedictory session both for senate and house of reps say bye-bye to di 8th National Assembly.
Senate President Bukola Saraki say, "im goal for life na to serve Nigeria" and im go serve her always for any capacity.
Senate Valedictory Session: We fight for democracy and hold goment accountable - Saraki
I no get any regret to fight for democracy and hold goment accountable na wetin Bukola Saraki tok.Di President of di 8th Senate, Bukola Saraki and oda principal officers don take dia bow afta di valedictory session to mark di end of di tenure.

Wia dis foto come from, Abubakar Bukola Saraki
Oga Bukola wen e dey address im colleagues say need dey for di kontri to build strong democratic institutions wey go epp develop di kontri.
E say although di 8th senate face plenti kasala during di tenure plus say I'm too suffer wella for Code of Conduct Tribunal, di 8th senate try dia best to make law wey touch ordinary pipo."We gatz dey proud of our legacy for di people. We form plenti round table to address issues wey dey affect ordinari pipo for we kontri and we address issues like drug abuse and human trafficking."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Saraki also explain give say need dey for executive arm of goment to constantly do tok tok wit di legislators on top di issue of budget, adding dat di National Assembly no be rubber stamp and di executive gatz understand say additions to the budget na part of National Assembly responsibilities.
He also note say even if di Assembly no confam some appointment by di president no mean say na quarrel and dat need dey for di two arms of goment to work togeda to build beta goment for Nigerians.
End of Di one wey oda users dey read well well
Failure not to confirm some appointment no be to cause quarrel. E say e go define di 8th Senate as lawmakers wey fight for democracy and hold goment accountable.
Saraki bin dey tank Naija pipo for di big opportunity wey dem give am to serve as Senate president wen di 8th National Assembly do dia final sitting on Thursday.
As e be so, Presido Muhammadu Buhari go inaugurate di 9th assembly next week, wey go make Nigeria national laws for di next four years.
Na on 9 June 2015, both houses of di National Assembly begin siddon.
According to di Nigeria 1999 Constitution, both di senate and house or reps go continue to siddon make laws, until di last day wey go complete dia four-year period.
Dat na why dem no dey follow govnors and president do swearing-in for May 29 wey be hand over day for Nigeria.
Di National Assembly no fit begin work until di president inaugurate dem and dis fit only happun afta May 29 wen di president don enta office.
How Nigerians go take remember 8th National Assembly?

Wia dis foto come from, @nass
Many Nigerians no go forget di plenti drama, political magomago, security harassment and kasala wey happun for di life of dis assembly.
Na di very first day wey dem inaugurate dis 8th assembly dia yawa start.
Like di Game of Thrones, Bukola Saraki, Yakubu Dogara, Ahmed Lawan and Femi Gbajabiamila bin dey hustle who go be leaders of di two chambers of di National Assembly.
While di ruling APC dey support Ahmed Lawan and Femi Gbajabiamila to lead di senate and house of reps, di Saraki and Dogara group kick against am.
So wen di party and Presido Muhammadu Buhari bin call all di lawmakers to gada for International Conference Centre for meeting to solve di wahala, na so oga Saraki and Dogara dribble dia party and do dem one chance elect dia leaders. Dis one make am difficult for di two principal officers to get beta rapport wit di president.
Mace tiff

Wia dis foto come from, Nigeria Senate
Body bin weak Nigerians wey dem hear say some jaguda boys beat National Assembly security come steal mace during plenary.
Dis one shock plenti Nigerians because di mace na di symbol of authority for di leadership of di senate, but no be today lawmakers begin carri di mace run.
Di senate accuse one of dia own - Senator Ovie Omo-Agege wey dey loyal to Presido Muhammadu Buhari say na im arrange di boys wey tiff di mace and suspend am.
But days later, police come find di mace for under flyover near di Abuja city gate.
Security pipo block assembly gate

Wia dis foto come from, Getty Images
Just as Nigerians dey recover from dat shock, na so security pipo from DSS wit guns storm di National Assembly block di gate say make no lawmaker enta.
Di event bin happun days afta about fifty lawmakers bin defect from APC to PDP before di election.
Right activists and di opposition bin describe di move as a way to intimidate di leadership of di National Assembly because of di kwanta between dem and di presidency.
Dat wan bin make vice president Yemi Osinbajo to sack di den DSS oga.
Kwanta over budget padding

Wia dis foto come from, Bayo Omoboriowo
Di National Assembly bin dey accuse some goment offices say dem dey pad budget but breeze come blow wen presidency reveal say dem too put moni for di budget to cover dia constituency projects.
Di presidency bin say lawmakers bin do wayo wayo chook 70 new road projects for di 2018 budget.
Although di lawmakers argue say na around 24 items dem put for di budget.
Law, law, law

Wia dis foto come from, Other
Dis National Assembly go also enta record for di ogbonge laws wey dem pass.
Dem pass bills like di Discrimination Against Persons Wit Disabilities Prohibition Bill, Not-Too-Young to Run Bill, New Minimum Wage Bill e.t.c
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2













