E no true say we wan reduce di number of pikin wey woman fit born - Finance Minister

Finance Minister Zainab Ahmed

Wia dis foto come from, Nigeria Government

Wetin we call dis foto, Finance Minister Zainab Ahmed
Read am in 2 mins

Nigeria Finance Minister Zainab Ahmed don tok say goment no wan put number on top di amount of pikin woman fit born.

She gree say Nigeria goment dey torchlight how mama dem dey cari belle so plus dem and dia pikins, dem fit strong and healthy.

Ahmed say child spacing, wey be gap of 2-3 year between one belle to di next one for woman na di way forward.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Na for di 24th Nigerian Economic Summit wey dem do for Abuja Ahmed first answer kweshon on top di kontri population.

Her answer come make pipo suspect say goment wan make pipo reduce di number of pikin wey woman fit born.

She tok say goment don already follow traditional leaders tok to take know how di mata go fit work for di kontri.

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

She say di way wey Nigeria population dey grow dey go so, na serious problem as goment dey try achieve dia Economic Recovery and Growth Plan (ERGP).

Wetin we call dis Video, "Dem say make I kill my own pikin"

Di plan wey Mrs Ahmed tok on Tuesday na to control di way Nigeria population dey grow but she dey claim say na child spacing instead of to reduce amount of children mama dem fit born she get for mind.

China na one kontri wey don get over population palava and dem do law for dia pipo wey tok say na only one pikin pesin fit born. But dem don increase di number to two.

Wetin we call dis Video, Wetin my eye see for all di years wey I dey find pikin

E neva clear how goment go handle dis kain policy because for Nigeria, pipo believe say na God dey give pikin and nobodi fit determine how many woman go born.