Lagos APC primaries don turn abracadabra as election committee say e neva hold

Ambode and Sanwol-Olu

Wia dis foto come from, Ambode/APC

Wetin we call dis foto, Govnor Akinwunmi Ambode and Jide Sanwo-Olu wey dey drag APC tickect to be Lagos govnor

Di election committee wey suppose conduct di primaries of di All Progressives Congress (APC) for Lagos State say di election neva hold.

From 8am on Tuesday, thousands of di party supporters bin come out to vote for dia candidate for different wards for di state. BBC tori pipo wey full ground, cari eye see say voting happun and even di national leader of di party Bola Tinubu come out vote. But di election committee say all dat one na waste of time.

Di chairmo of di committee, Chief Clement Ebri wey tok to tori pipo around 4:20pm on Tuesday, say dem don ready to do di election.

"We bin do meeting wit those wey dey involved on Monday and di National Working Committee say make we make some kain adjustments," im tok.

"Anytin wey dem do witout di list wey we suppose use do di election...we do meeting wit representatives of di two candidates as at 8am on Tuesday morning."

Wetin we call dis Video, APC Govnorship aspirant Babajide Sanwo-Olu confident say victory sure

Dat one fit explain why Govnor Akinwunmi Ambode no come out to vote for di primaries for im ward for Epe.

Govnor Ambode and Babajide Sanwo-Olu dey drag diasef to win di ticket of dia party for Lagos State, di heavyweight state for Nigeria.

APC voters carri dia id card up before voting - for Ikeja Ward C, poling unit 003
Wetin we call dis foto, APC voters don ready for Ikeja Ward C, poling unit 003

Lagos state: Govnor Ambode dey look im back

APC members don begin vote for Epe
Wetin we call dis foto, Voting don begin for Epe wia Akinwumnmi Ambode supporters full

Since 1999, evri govnor for Lagos don serve two-two term, but dis time dat one fit change as di tori wey full ground be say di govnor and leader of di party, Asiwaju Bola Tinubu no dey see eye to eye.

Wetin we call dis Video, APC primaries: see how Ambode and Sanwo-Olu take drag diaself

Govnor Ambode don tok say e no true im and Tinubu, wey tori pipo don report say dey support Sanwo-Olu, get any kwanta.

But as 36 out of di 40 lawmakers for di state House of Assembly don support Mr Sanwo-Olu as dia captain, Ambode fit face relegation true true.

Grey line wey dey

As e dey happun - Lagos APC Govnorship Primaries

- Babajide Olusola Sanwo-Olu go vote for St. Stephen's primary school, Adeniji Adele, Lagos Island.

Wetin we call dis Video, APC Primaries: Akinwunmi Ambode no gree vote even as supporters gada for im Epe House

- Govnor Akinwunmi Ambode go vote for Recreational Centre for Epe.

Id card of APC member wey come vote for di party primaries
Wetin we call dis foto, Di material wey dem print di id card ontop be like cardboard, no be plastic

Party ID cards don ready but na for voting centre dem go distribute am.

One APC member tell BBC reporter say officials dey give members wey no support 'dia candidate' problems - dem go say dem no fit find dia card.

Official hold APC id card to distribute
Wetin we call dis foto, APC official comot days ago to announce say no id cards, no voting