Angela Merkel visits Nigeria: How Merkel, May & Macron visit fit help Nigeria

Muhammadu Buhari and Angela Merkel

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Oga Buhari, na im first visit Angela Merkel for Germany for June 2015

German Chancellor Angela Merkel na di latest leader from three big European kontris including Britain Prime Minister Theresa May and France Presido Emmanuel Macron wey don mark register for Nigeria visitors book between July and August 2018.

Di visits of dis three kontris, wey get di biggest economies for Europe, go sweet di belle of di current Nigeria goment as sign say di kontri democracy don grow.

Sabi pipo never forget how America Presido Barack Obama bypass Nigeria, wey get one of Africa's biggest economy and population, instead visit Ghana wia im tok say di Black Star kontri na example of true democracy.

See how Macron, May and Merkel visits fit help Nigeria

Angela Merkel visits Nigeria

Wia dis foto come from, Deustch Welle

1. Angela Merkel - Illegal Migration

Germany na Europe biggest economy, and migration, security, economic paddy paddy and 2019 election for Nigeria na di mata wey bring Angela Merkel come Nigeria.

Madam Merkel swear to fight illegal migration wen she meet Presido Muhammadu Buhari on Friday morning but dem no sign any agreement to return Nigerian migrants wey dey her kontri.

Di German leader say at least 30,000 Nigerians dey live for Germany wit no paper to remain for di kontri.

Germany migration palava

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Thousands of migrants dey enta Germany evri year

Migration don shake Merkel goment sotay her members of her conservative goment lose plenti seats for dia last election dis year and her coalition partners for goment no dey see eye to eye wit am on top di mata.

Even for European Union, members never gree on di best way to stop di wahala.

From 29th to 31st August, Merkel first enta Senegal first, followed by Ghana then Nigeria.

Wetin join dis three kontris be say dem be regional nebors for West Africa and dem follow join di highest number of migrants wey dey run go Europe through Libya.

Unto mata say illegal migration na one of di biggest headache for Germany wey don open im door to allow hundreds of thousands.

Merkel and Buhari gree say, if young pipo get work for Nigeria dem no go wan run comot go Europe.

Na dis ginger her to sign agreement for faming and motor production wey go include loan for farmers dem.

2. Theresa May - Business

British Prime Minister Theresa May begin her three-day waka to Africa from 28th to 30th August 2018. She first land South Africa before she show for Nigeria on Wednesday 29th den waka go Kenya.

For Nigeria, she bin sign agreement on Defence and Security wey go include how to take fight Boko Haram and oda killi-killi groups for West Africa.

May and Buhari

Wia dis foto come from, @NGRPresident

Wetin we call dis foto, For social media, na madam May ankara jacket pipo dey cut eye

Oda deals UK signs for Nigeria include;

  • Nigeria military go get special equipment and for di first time, training to fight militants wey dey use bombs kill innocent pipo.
  • Di UK go start special military units for Nigeria wey go helep stop di spread of informate wey militant groups dey spread.
  • UK announce contribution of £16 million to helep 100,000 pikin dem, wey don suffer for di north east, go school.
  • She sign deal of £10.5m to helep pipo wey dey suffer di wahala of modern slavery.
  • 1,700 victims of by-force labour go get counselling and support to live beta life.
  • UK goment fo helep Nigeria return money and property wey wayo pipo steal come keep for Britain
May and Buhari

Wia dis foto come from, @NGRPresident

Wetin we call dis foto, Part of di agreement wey Nigeria sign wit UK for dis visit na ontop how to fight Boko Haram

Since di United Kingdom dey cari e leg comot for di European Union alias Brexit by March 2019 e make sense make dem find new friends wey wan follow dem do business.

So di trip na part of di British goment plan to join body wit oda ogbonge Africa kontri on top trade mata.

Di tin wey join Britain with Nigeria, South Africa and Kenya be say, na dem be regional champions for southern, west and east Africa.

Di prime minister sharperly for her speech for Cape Town promise say di kontri dey support Africa economy wit four billion pounds to helep dem create jobs for young pipo.

3. Emmanuel Macron - Culture

President Emmanuel Macron, Governor of Lagos State, Akinwunmi Ambode

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Plenty pipo come New Afrika Shrine to come see President Emmanuel Macron korokoro

France Presido Emmanuel Macron on July 4, 2018. write history as di first ever oga of goment wey go visit di New Afrika Shrine for Lagos, south west Nigeria

Oga Macron tok say im believe say di shrine, wey late Afrobeat star Fela Anikulapo Kuti bin start, na di correct place to show di kontri ulture.

Macron first sidon wit Nigeria Presido Muhammadu Buhari for Abuja to nack head on top business and security mata.

Tori be say Nigeria fit gain military support weda na equipment or training from France to fight di militants wey dey scatter states wey tanda for Nigeria north east region.

New Afrika Shrine
Wetin we call dis foto, New Afrika Shrine

Sabi pipo say di tin wey Macron waka go do pass na to torchlight and cari Nigeria ogbonge entertainment industry, weda na culture, music, dance and art, reach di next level.

E don confam Nigeria is one of di entertainment capital for di continent.

Also for mata of tourism, Macron trip don cari di New Afrika Shrine go places wia e never enta before and e fit increase tourism for Lagos state first and Nigeria join.