Theresa May: Five Nigeria women wey strong like di UK Prime Minister

Oby Ezekwesili, Amina Mohammed and Arunma Oteh

Wia dis foto come from, Getty Images/BBC Pidgin

Wetin we call dis foto, No be today Nigeria don dey produce ogbonge women dem
Read am in 2 mins

As UK Prime Minister Theresa May don land Nigeria so, BBC News Pidgin dey look oda Nigerian women wey get power as di madam Prime Minister.

Oby Ezekwesili

Oby Ezekwesili

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Oby Ezekwesili na co-founder of Transparency International

Campaigner and leader of di Bring Back Our Girls (BBOG) movement, Obiageli Ezekwesili na forma Vice President of World Bank Africa division.

She also serve as Minister for Solid Minerals and also Minister of Education during Olusegun Obasanjo goment.

She be one of di most influential females for Nigeria wey no dey waste time to chook mouth inside mata wey concern young pipo.

Ngozi Okonjo-Iweala

Ngozi Okonjo-Iweala
Wetin we call dis foto, Ngozi Okonjo-Iweala bin be di managing director of World Bank from 2007-2011

She be economist and di first female Minister of Finance for Nigeria.

Okonjo-Iweala graduate from Harvard University and serve as Finance Minister two times under president Olusegun Obasanjo and president Umaru Musa Yaradu'a. She also serve for di Goodluck Jonathan goment.

Twitter for July 2018, name her for dia board.

Chimamanda Ngozi Adichie
Wetin we call dis foto, Adichie na di author of 'Why We Should All Be Feminists'

Chimamanda Ngozi Adichie

Ogbonge writer wey don go worldwide and don win plenti accolades like di MacArthur Foundation fellowship.

She be big believer of di feminism movement.

Amina Mohammed

Amina Mohammed

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Amina Mohammed serve as Minister of Environment for Nigeria from 2015-2016

Nigeria forma Minister for Environment Amina Mohammed na United Nations most powerful woman as she be di UN number two pesin.

She resign as minister for Nigeria for 2016 to take up role as di UN Secretary-General.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Arunma Oteh

Arunma Oteh

Wia dis foto come from, Getty Images

She be di Treasurer and Vice President of World Bank since September 2015.

Oteh also serve as Director General for Securities and Exchange Commission of Nigeria. She graduate from Harvard Business School.