Macron: France no dey order Africa on wetin dem suppose do

Wia dis foto come from, Getty Images
French President Emmanuel Macron wan separate im self from before-before French leaders wey feel say dem suppose tell Africa people wetin to do and how to do am.
Macron talk dis one for Ouagadouguo, Burkina Faso on Tuesday.
For im speech wey im give university students for Ouagadougou, im say, "I come from generation wey no come to tell Africa people wetin to do."
E say im generation see Nelson Mandela victory as "one of di best political memories."

Wia dis foto come from, PASCAL GEORGE
Expose secret French file
Di young president say im go expose di secret file dem wey concern assassination of Thomas Sankara, Burkina Faso revolution leader.
Thomas Sankara be Burkina Faso military captain and president from 1983 to 1987 before some soldiers kill am.
Attack on French army
Before Macron enter Ouagadougou, terrorist throw bomb near French army wey dey inside di town. Na three civilians wound.
Dis na first time wey Macron dey visit Africa and im dey do three days visit to West Africa.
End of Di one wey oda users dey read well well
Inside di visit im go attend di EU- Africa summit wey go happen for Abidjan.










