Theresa May ankara jacket and oda foto dem as UK Prime Minister and Nigeria Buhari sign agreement

Wia dis foto come from, @NGRPresident
UK Prime Minister Theresa May land Nigeria Wednesday afternoon afta her trip to South Africa.
She land for di Nnamdi Azikiwe International airport for Abuja from dia she enta Nigeria presidential villa - Aso Rock wia she meet President Muhammadu Buhari.
For dia meeting, Nigeria and UK sign agreement on Defence and Security wey go include how to take fight Boko Haram and oda killi-killi groups for West Africa.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
Di trip na part of di British goment plan to join body wit oda ogbonge Africa kontri on top trade mata and dis dey important as di kontri plan to leave di European union alias brexit by March 2019.
Di prime minister sharperly for her speech for Cape Town promise say di kontri dey support Africa economy wit four billion pounds to helep dem create jobs for young pipo.
Foto dem of madam May meeting wit oga Buhari

Wia dis foto come from, @NGRPresident

Wia dis foto come from, @NGRPresident

Wia dis foto come from, @NGRPresident

Wia dis foto come from, @NGRPresident

Wia dis foto come from, Empics

Wia dis foto come from, @NGRPresident

Wia dis foto come from, Bayoomoboriowo

Wia dis foto come from, @NGRPresident
"We want strong institution and not handouts from UK" - Nigerians dey tell BBC News Pidgin as madam May land on Wednesday.
But some Nigerian sabi pipo say, no kontri fit help anoda kontri create job and sustain am and dat wetin Nigerians want from Britain na to help di kontri build and strengthen im democratic institutions.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Development Economist, Odilim Enwegbara explain give say any investment wey Britain go do for di kontri must dey specifi, if not, di whole gain go go back to di kontri.
End of Di one wey oda users dey read well well
"E good make African leaders open up dia economies for foreign investment but dem must own and kontrol it and put dia qualified pipo so dat technology transfer go dey possible" im explain.
Meanwhile di volume of trade between Nigeria and Britain bin don dey reduce tey tey. E dey around 3.7 billion pounds and dis na why di British goment dey look for creative ways to boost im investment.
Anoda sabi person, Bongo Adi say im go like to see May help Nigeria recover all dey tiff-tiff money wey dey im kontri.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Madam Prime Minster say Nigeria president and Theresa May must colabo on top corruption mata as na one big tin wey don destroy di kontri finish.
She say although China don get beta investment for Africa and don helep plenti Africa kontries for infrastructure, e still no mean as Britain still be big player for most anglophone kontries.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di sabi pipo tell BBC pidgin say dem wqant partnership wey go make di kontri develop and prosper and not handouts from di UK in terms of aid.
Already Britain don already announce to return £70 million pounds tiff money wey corrupt pipo carri from Nigeria go UK according to Paul Arkwright, di UK Ambassador to Nigeria.












