Emmanuel Macron: Why France President enta New Afrika Shrine

Wia dis foto come from, Getty Images
France President Emmanuel Macron don write history as di first president for office wey go visit di New Afrika Shrine for Lagos Nigeria.
Oga Macron say im come Nigeria as part of plan to build beta relationship with Nigeria and im believe say di shrine, wey Late Afrobeat star, Fela Anikulapo Kuti start, na correct place wey represent culture.
Di French presido first go meet Nigeria President Muhammadu Buhari for Abuja to discuss investment and security mata.
Afta di Abuja jaw-jaw, Macron, wey be di youngest France president for history, fly go Lagos to jolly for di New Afrika Shrine.
Plenti Nigerians dey feel say di Shrine na di spiritual house of Afrobeat.
For event wey plenty big big pipo full, from politicians to entertainment celebrities, Macron join Lagos State Governor Akinwunmi Ambode to watch pipo like Femi Kuti perform.
Mr Macron also meet Karim waris, di young Nigerian boy wey dey do correct painting.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Macron praise Nollywood wey bi Nigeria feem industry, and di music of di kontri. Dis na afta some Nollywood actors act small feem on stage wia dem carry Macron take do director.
End of Di one wey oda users dey read well well

New Afrika Shrine, wey dey di heart of Ikeja, Lagos na popular music place and nightclub wey dey full wit marijuana smoke, sexy backup dancers and anti-goment music. But na also di place wia dem do to take remember di life and music of ogbonge musician and activist, Fela Anikulapo Kuti.
"You no need to do like say di bad tins wey don happun for dis history no happun, but you suppose move forward," di 49 year-old president bin tok to Nigerians wey listen to am.

Wia dis foto come from, Getty Images
E surprise many pipo say Macron visit 'shrine' because of di kain anti-goment music wey dem dey play dia - di same type wey Femi Kuti, Fela pikin dey perform dia.
But no be di first time wey di France President go visit New Afrika Shrine be dis. Im don tok am before say for year 2000, im kontri send am come Nigeria to work and na den im first come 'shrine'.

On Wednesday, im go launch di new Alliance Francaise, wey bi cultural centre, to torchlight beta relationship with young Nigerian entrepreneurs.













