Rabiu Kwankwaso na di latest pesin wey wan become Nigeria president for 2019

Wia dis foto come from, @RMKwankwaso
Na red colour full evriwhere for Jabi, Abuja, Nigeria capital as presidential aspirant Senator Rabiu Musa Kwankwaso declare in plan to contest for president.
Wen Senator Kwankwaso first apply to goment to allow am use di Eagle Square, dem bin give am permission, but tori change for di last minute.
Nigeria goment no allow am use Eagle Square to declare im intention again as dem change dia mind come cancel di permission.
But dat one no stop di senator as im later use Chida hotel do im declaration and thousands of im supporters wey gada wear red colour as solidarity for di man wey dey famous sake of im red cap.
Goment decision make some Nigerians dey para for social media.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Rabiu Musa Kwankwaso, dey among di senators wey bin port from di ruling All Progressive Congress (APC) go People's Demcratic Party (PDP) for July dis year.
Many believe say goment cancel di approval wey dey first give am becos im port.
E still get pipo wey dey support di goment decision on top dis mata or even believe say all dis na drama.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2

End of X post, 3