Bukola Saraki: Dino, Kwankwaso, odas, how many times dem decamp from one party to anoda

Dino Melaye

Wia dis foto come from, @dinomelaye (Instagram handle)

Wetin we call dis foto, Senator Dino Melaye dey part of di 15 senators wey waka comot from APC

Kontri pipo say wen breeze blow fowl yansh go open, na im make di different kain movie wey happpun on Tuesday inside di Nigeria National Assembly no surprise pipo.

No be today politicians for ruling party dey cross carpet go opposition party or di oda way round.

38 members of di House of Representatives and 15 Senators from di ruling All Progressives Congress (APC) party park dia kaya waka comot from di party .

How many times dem decamp from one party to anoda?

Before now, most of di senators bin dey Nigeria number one opposition party, People's Democratic Party.

List of senators

Wia dis foto come from, Alamy

Whereas, some even go as far back as being part of Social Democratic Party (SDP), one of di oldest political party for Nigeria.

Dis na di names of di politicians wey carry dia kaya waka comot from APC on Tuesday.

  • Rabi'u Kwankwaso (Kano-Central) - SDP - PDP - APC - PDP
  • Dino Melaye (Kogi-West) - PDP - APC - PDP
  • Adesoji Akanbi (Oyo-South) - APC - PDP
  • Monsurat Sunmonu (Oyo-Central) - ACN - APC - ADC
  • Rafiu Ibrahim (Kwara-South) - APC - PDP
  • Suleiman Hunkuyi (Kaduna-North) APC - PDP
  • Lanre Tejuoso (Ogun-Central). - ANPP - CPC - ACN - APC - PDP
  • Usman Nafada (Gombe) - ANPP - PDP - APC - PDP
  • Ibrahim Dambaba (Sokoto) - APC - PDP
  • Mohammed Shittu (Jigawa) - APC - PDP
  • Isa Misau (Bauchi) - APC - PDP
  • Suleiman Nazif (Bauchi) - AC - ANPP - APC - PDP
  • Shaaba Lafiagi (Kwara) - SDP - PDP - APC - PDP
  • Barnabas Gemade (Benue) - PDP - APC - PDP
Speaker of di House, Yakubu Dogara, na im read di letter for di green chamber of di NASS.

Wia dis foto come from, Nigeria House of Representatives

Wetin we call dis foto, Speaker of di House, Yakubu Dogara, na im read di letter of defection of 38 House of Reps members on Tuesday for di green chamber of di NASS.

In fact, Nigeria Presido Muhammadu Buhari don wish goodluck to all di members of di ruling APC party wey waka comot di party on Tuesday. E say make di remaining members of APC see dis cross cross as normal tin wey dey happun just before fresh elections.

Many of dem including 14 Senators and 34 House of Reps members cross enta di main opposition party, People's Democratic Party (PDP) party, di odas run go APp party wey be anoda opposition party for Nigeria.

Nigeria Senate

Wia dis foto come from, @NGRSenate

Wetin we call dis foto, President of di Senate, Bukola Saraki, read letter from di 15 members wey say dem don defect from di APC go di PDP.