National Assembly: Senate na retirement home for former governors?

Former govnor for Cross River State for south-south Nigeria, Donald Duke tweet recently say for peace to dey dey inside di kontri senate, make dem stop to dey make di place 'retirement home' for former govnors dem.
Dis tweet don bring different reactions from plenti pipo inside Nigeria as some dey support wetin im tok and some dey kick against am.
Dis na wetin Duke post for Twitter.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
No be only for twitter di mata end, Lawyer and political analyst, Kurtis Adigba tell BBC Pidgin say to some extent, Donald Duke dey right wit wetin im tweet and for oda areas no be like dat.
"If to say Nigeria arrange di senate to work for di kontri and di pipo, senate no go be like dat. But if dem arrange di senate to be like place where pipo wey don serve for big position and dem no get where to go again, dem go just go siddon there, then Duke dey right. You sabi say im na former governor and e know wetin im dey tok about."
"Di problem be say if you no sabi wetin be di purpose of sometin, you go abuse am."
Dis na reply wey some pipo for twitter give Donald Duke shaperly.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
Concerning di fact say na through vote pesin fit enta senate, oga Adigba say na wen di former govnors dey for power, dem dey build di ladder wey dem wan use climb enta senate afta dem leave office.
End of Di one wey oda users dey read well well
"As govnor di whole state na dia constituency, dem get plenti pipo wey sabi dem like local govment chairmen, councillors and commissioners wey dem appoint. So wen dem wan be senator na just one third of di whole dem just need. E go just dey easy for dem to enta because dem get money, power and control already inside di state," im tok.
Former Governors wey be Senators

- Sen. Bukola Saraki - former Govnor of Kwara State from 2003 2011
- Sen. Rabiu Musa Kwankwaso - former Govnor of Kano State from 1999 to 2015
- Sen. Godswill Akpabio - former Govnor of Akwa Ibom State from 2007 to 2015
- Sen. Theodore Orji - former Governor of Abia State 2007 to 2015
- Sen. Abdullahi Adamu - former Govnor of Nasarawa State from 1999 to 2007
- Sen. George Akume - former Govnor of Benue State from 1999 to 2007
- Sen. Samuel Ominyi Egwu - former Govnor of Ebonyi State 1999 to 2007
- Sen. Mohammed Danjuma Goje - former Govnor of Gombe State 2003 to 2011
- Sen. Muhammad Adamu Aliero - former Govnor of Kebbi State from 1999 to 2007
- Sen. Mohammed Shaaba Lafiagi - former Govnor of Kwara State from 1992 to 1993
- Sen. Ahmed Rufai Sani Yerima - former Govnor of Zamfara State from 1999 to 2007
- Sen. Bukar Abba Ibrahim - former Govnor of Yobe State from 999 to 2007
- Sen. Aliyu Magatakarda Wamakko - former Govnor of Sokoto State from 2007 to 2015
- Sen. Joshua Chibi Dariye - former Govnor of Plateau State from 1999 to 2007
- Sen. Jonah David Jang - former Governor of Plateau State from 2007 to 2015.
Nigeria get 36 governors and about 16 of dem wey don be govnor before don be senators now.











