Bauchi bye-election: Lawal-Yahaya Gumau wan go senate to make Buhari president for life

Wia dis foto come from, APC twitter
Lawal-Yahaya Gumau wey be di candidate of di All Progressives Congress for Saturday bye-election for Bauchi State south senatorial district say im plan na to change Nigeria constitution to make Muhammadu Buhari president for life.
Gumau wey already dey represent Toro Federal Constituency for House of Representatives and don do eighth years, say di only tin wey dey cari am go Senate na to protect Buhari interest.
According to Nigeria tori pipo Punch, im tok am wen im dey end im campaign for Bauchi State on Thursday.

Wia dis foto come from, APC twitter
Im say: "by God grace, we go change Nigeria Constitution to allow Buhari to be president for di remaining years of im life. Im go only stop to be president wen God take im life.
"Obasanjo try everitin to change di constitution to allow am go for third term, but God no approve am because im no be beta pesin. Wetin we need for Nigeria now na to protect Buhari interest and dat na wetin we go do."
Social media no waste time begin react to wetin im tok:
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3