2019 Election: INEC confident say National Assembly go soon approve election budget

Wia dis foto come from, Twitter/@SPNigeria
Nigeria election office INEC don tok say dem get hope say soon dem go get di money wey dem need to run di 2019 general elections.
Dis dey come afta meeting wey National Assembly leaders and INEC oga Mahmood Yakubu hold on Wednesday.
Tori na say di leadership of di National Assembly and some of di principal officers hold meeting wit di INEC oga Mahmood Yakubu on top how to pass dia supplementary budget.
Di goment bin don ask di National Assembly wey dey brake make dem come back work to chook eye on to di issue plus oda National mata.
Di National Assembly leaders afta dem tok with INEC oga, Mahmood Yakubu e come ask dem wetin be dia immediate need.
Afta all di talk-talk, di senate President come assure di INEC oga say di National Assembly go come back to work if need dey to chook eye for di mata to make sure say dem no dey under pressure.

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI
Di senate Presido bin explain give say goment dey since and e no bring di supplementary budget until now and dat dey delay na from di executive.
One of INEC pesin wey no want make we mention im name say di meeting wey dem hold wit National Assembly leadership dey productive.
End of Di one wey oda users dey read well well
E explain give say im get assurance say INEC go soon get di money wey dem need to carry do election.
Meanwhile di special assistant to President Muhammadu Buhari on top National Assembly mata, Ita Enang bin say goment go shut down if dem National Assembly no reconvene to pass di virement and supplementary budget.










