Fela Durotoye: 'Those wey dey lead us now suppose don retire'
Fela Durotoye wey be one of di presidential aspirant for di 2019 election for Nigeria siddon yan wit BBC Pidgin about young pipo and how dem suppsoe dey involve for politics.
Di 47 years old na one of di young candidates wey dey come out for di next election, e tok say even if e no work out di first time, no wahala.
