Urine test wey fit show if your pikin dey do codeine

- Author, Dooshima Abu
- Role, BBC News Pidgin, Abuja
Abuja wey be capital of Nigeria na ogbonge city and e get swag. But despite di beauty, codeine issue na big wahala here.
Dis na wetin Doctor Dayyabah Shaibu wey di treat pipo wey dey addicted to drugs tell BBC News pidgin.
She say since her practice for Abuja, most of di case for addiction na codeine and she happy say BBC Documentary don open pipo dem eye.
She add say codeine wahala no be onli for poor pipo as even rich pipo pikin dem di suffer am and na im make plenti private rehabilitation centre full Abuja.

How u fit test your pikin for codeine
Doctor Dayyabah explain give say e get urine test kit wey parent fit use for house to know weda dia pikin dey use any kain drug including codeine.
Dey kit be like cup and e come get 12 different line with colour wey dey show di different drugs.
If your pikin piss inside di cup and im or her dey do drug, you go see one line show.
If im no dey do, two line go show and if you see one line show for down, den e mean say you no do am well.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dayyabah say dis one dey necessary as e go help parent sabi wetin dey happen fast-fast and find help for dia pikin for hospital before dem go turn addict.















