Codeine syrup abuse dey make fear catch me - Aisha Buhari

Aisha Buhari

Wia dis foto come from, Aishabuhari

Wetin we call dis foto, Nigeria first lady no sabi hide mouth wen sometin pain am
Read am in 1 mins

Nigeria first lady, Aisha Buhari say di way youths and even adults for di kontri dey take abuse codeine cough syrup dey make fear catch her.

Di president wife bin dey react to BBC Pidgin and Africa Eye investigation wey show how pipo for Nigeria especially youths dey take abuse codeine and di magomago wey some pharmaceutical companies dey do to take sell am for black market.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

"I don take note wit fear for mind of how drug abuse dey rise for our kontri, especially for di North," she talk.

"As pesin wey get pikin, e dey pain me well-well, and e dey important make we stop how e dey go and encourage our children to stay drug free."

She come talk how her project Future Assured get nationwide youth training and empowerment program wey be say dem dey find ways to take engage youths.

"We also recently launch war against substance abuse campaign. As dat one dey go, di wives of Northern Governors dey work day and night on dis issue. Dem don recently renovate and commission one rehab center for Kogi and Kebbi state, while dem dey work to do more for oda states.

"I call on all security agencies, lawmakers, judiciary, drug manufacturers, civil society, regulators, teachers, parents, neighbours and YOU to take dis as personal war and stop dis bad tin."

You fit watch di full 1 hour video of 'Sweet Sweet Codeine' here:

Wetin we call dis Video, Sweet Sweet Codeine: Di cough syrup wey dey destroy lives for Nigeria