Sweet sweet codeine: Drug abuse na evribodi problem - Saraki

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria Senate President Bukola Saraki don follow First Lady Aisha Buhari put mouth for drug abuse problem wey dey happen among young pipo for Nigeria.
BBC News Pidgin and Africa Eye bin do collabo film 'Sweet sweet codeine' to torchlight how pipo dey abuse cough syrup wey get codeine inside and how some pipo for drug companies dey use back door to sell di tin for black market.
Mr Saraki say dis kain film wey BBC do show say dem suppose put eye for di problem well-well.
"Na because of dis kain tin make goment do meeting for Kano for December to see how to solve di problem.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2
Di senate president say afta im watch di BBC film, e dey clear to am say if dem no careful, di tin fit turn to serious gbege.
E say "we no fit sidon dey look, come dey expect say di problem go solve e sef."
Meanwhile, local tori pipo Vanguard Newspaper, dey report say goment don order say wit immediate alakriti, make NAFDAC stop to dey give pipo permit to import codeine enta di kontri.
End of Di one wey oda users dey read well well
Tori be say Health minister, Professor Isaac Adewole, tok say di mata don pass be careful because of how pipo dey drink am.
Emzor Pharmaceuticals, big company wey dey manufacture drug for di kontri sack one of dia sales rep wey use wuru-wuru sell Emzolyn syrup to undercover BBC reporters inside di film.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
Di company say dem no dey sell dia Emzoyln codeine cough syrup to pipo anyhow.
Dem bin first suspend dia sales rep but last last dem sack am afta dem investigate di mata.
Oga Saraki tok say di Drug Control Bill wey dem wan bring come na law wey go help agencies wey dey fight bad drugs like di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) and the National Agency for Food and Drug Administration Control (NAFDAC).