You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Dino Melaye arrest: Nigeria Immigration say na police tell dem to block di senator
Nigeria Immigration Service say dem bin stop Senator Dino Melaye from im journey to Morocco because dem get order from police.
Di talk-talk pesin for Immigration, James Sunday say di senator dey police watchlist na im make.
Police don dey try tey-tey to gbab Dino afta dem say e give some bad boys guns to cause kata-kata for Kogi State north-central Nigeria.
"We get directive to stop am and na im make we do dis one but di koko be say we no detain am, we just intercept am," im talk.
Di senator bin nack am for social media early mormor say dem hold am for Nnamdi Azikiwe International Airport for Abuja as e dey travel go Morocco.
Police talk-talk for Police Zone 7 Abuja, ASP Istifanus Sunday Bako bin tell BBC News Pidgin say dem arrest di senator for di airport because im dey Interpol wanted list and im no suppose travel out of Nigeria.
Bako say as di senator wan travel, e be like say im wan run commot for Nigeria.