You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
British film star Idris Elba go soon marry
British actor, Idris Elba and im girlfriend, Sabrina Dhowre don engage after Elba knee down nack am di question "will you marry me?" for di preview for im new movie, Yardie.
Di movie na di first time Idris Elba go do director for im career and e use use propose give im 29 year old girlfriend.
Di news bin comot after Twitter user, David Marsden-Sainou, wey present for di preview, record di whole proposal, come post am for im page.
Di cinema hall wey e bin do di screening, Rio Cinema, follow confirm am.
Even as dem dey hail am, Twitter people para for Elba say why im no wait till Valentine Day.
Elba and Dhowre, wey be model and former Miss Vancouver, bin start to date since early 2017.
Di 45 year old actor don marry two times before to Hanne Norgaard and Sonya Hamlin.
People chook mouth well-well for social media on top di mata, plus including dis Nigerian-British comedian.
End of Di one wey oda users dey read well well
Even Somalians dey ginger say dia "sister" don snatch Idris Elba.
But e pain some people for belle say Idris Elba no dey market again.