Kwabenya Police Shootout: Five people don join suspect list

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Accra Police Command don arrest di person dem think say kill one police officer for Kwabenya Police District Headquarters last Sunday.
Di suspect na Kofi Seshie and be 28 years old.
Dem arrest Seshie with four other suspects on Saturday for Kasoa. Dis na from statement wey di police release.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
According to di statement, dis arrest go carry di number of di people wey dem don arrest on top di Kwabenya matter to 11 suspects dis week.
Gunmen bin enter di Kwabenya Police station on Sunday come free people wey bin dey custody after dem kill one police officer.
Di Police don talk say dem go give GHc15,000 to anybody wey get information wey go lead dem to arrest di four suspects wey bin escape from di police station.







