ISIS scare: Ghana police don begin investigation

Ghana police dey carry barricade

Wia dis foto come from, Getty Images

Inspector General of Police for Ghana, David Asante Apeatu, say dem don start investigations into di explosives wey dem seize from three suspects yesterday.

Police say di suspects who dey inside police custody now dey assist dem with investigations.

Ghana police service for press conference today reveal say demma investigations go try check if true-true one of the menerz dem catch be ISIS agent. Also dem dey check if he get any links for ISIS.

Dem also want look into how di suspects get dis kind explosives for demma body inside Ghana.

Na head of Police, Asante Apeatu, say dem dey work with solid intelligence so make Ghana den di international community no panic sake of dem dey ground.

Divisional police command for Ghana intercept seven hand grenades for Ghana after demma operation for Odokor.

Dem say di three suspects wey di police arrest admit say di explosives be demma suspects own; meanwhile security analysts say weak borders for Ghana be reason why dis weapons fit enter di country.

Local media report for Joy FM mention say one of di men dem reveal say he get some ISIS links, after dem find some pictures for in phone top.

But, police say dem no fit confirm any links wey he get plus ISIS.

Public Affairs Director for Ghana police ACP David Eklu release statement confirming di arrest happen.

Statement from Ghana police of arrests

Wia dis foto come from, Ghana Police Service

Wetin we call dis foto, Ghana police say investigation dey go on on top di mata

But dem no talk about any ISIS connection with one of di suspects dem arrest.

Di police say anyone wey get information related to dis case make dem come forward with am.