Cameroon say 34 fields dem go bi ready for December before CAF visit

Stadium

Before number four Confederation of African Football, CAF, inspection mission start for 10 November, Cameroon sports minister Pierre Ismael Bidoung kpwatt say 34 Afcon stadiums dem go bi ready for December.

Anthony Baffoe weh na assistant Secretary General for Caf weh e dis take care for sport development di lead de inspection mission weh e go start for number 10-15 November.

Deh go check all fields dem for Garoua, Bafoussam, Yaounde and Douala except Buea.

Seven of de 34 teams dem na for play ndamba and de 24 odas na for training for de teams during de competition.

Cameroon di host 2019 Afcon and deh go bi de first kontri for host de competition with 24 teams seven moons from now.

Sport Minister say kontri try for respect de rules weh Caf put for finish de stadiums dem for December 31.

De field dem dey for five sites, Buea, Douala, Bafoussam, Garoua and Yaoundé weh e get two field for play ndamba.

Goment don map for all hotel for officials, teams, referees and journalists with accreditation as Caf bin ask, den deh di improve hospital facilities.

Also, deh don identify place for accreditation centre, Afcon villages and deh don start for build dem and arrange for all tins for opening ceremony and oda activities.

Last week CAF security mission visit and work with Cameroon for check security especially if problem dey de taim e go take for komot all man for field.