Dr Stella Immanuel hydroxychloroquine video: Physician wey Facebook,Twitter delete her post say she promote drug WHO no support want patients to speak out

Dr Stella Immanuel covid

Wia dis foto come from, ScREENSHOT/TWITTER

    • Author, Onyinye Chime
    • Role, Broadcast Journalist, BBC News Pidgin
  • Read am in 3 mins

Dr. Stella Immanuel, di primary health care physician, wey say she don treat 350 Covid-19 patients wit Hydrochloroquine, don enta social media again to call pipo wey she and her fellow doctors don cure of coronavirus make dem speak out.

Evidence no dey say di drug fit fight di virus, and regulators warn say e fit cause heart problems.

She say, "if you don take hydrochloroquine and you don dey cured time don reach for you to speak up. We put our live, we put our family and our license for danger to treat you." She add say, "we need to let pipo know say real pipo don benefit from dis treatment and real pipo don get cure.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Earlier on Tuesday, Facebook, Twitter Periscope plus oda social media sites bin pull down viral video of Dr Stella wia she claim say she use hydrochloroquine, zinc and antibacterial medicine, Zithromax to treat 350 patients for United States of America.

But for her new tweet, Dr Stella insist say, "if dem allow dis go through, inside 30 days hydrochloroquine go stop Covid."

Dr Stella Immanuel Houston Texas

Wia dis foto come from, ScREESHOT

Wetin be di evidence say Hydroxychloroquine fit treat Covid-19?

Risks of serious side effects from use of hydroxychloroquine, including renal and liver damage also dey.

A study conducted by Oxford University find out say di drug no dey effective against Covid-19 in patients wey dey hospital dey recieve treatment.

How effective Hydroxychloroquine dey wen dem use am early on during treatment na wetin dem still dey study, as e be say dem dey use am as a preventative measure.

Medical trials have so far been inconclusive and the results of larger-scale randomised studies will be needed to know if it's effective or not.

In July, di US Food and Drug Administration warn against di use of Hydroxychloroquine outside any hospital setting because of possible risks to di heart from taking di drug.

Currently, na like dozens of hydroxychloroquine trials dey go on around di world.

Hydroxychloroquine

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Anti-malarial drugs
Dr Stella Immanuel biography

Wia dis foto come from, Getty/SCREENSHOT

Who be Stella Immanuel?

Dr Stella Immanuel na primary health physician for Houston Texas. She dey work for Rehoboth medical centre for Houston Texas.

Inside di part two of di conference video wey trend (YouTube don delete di video afta we write dis tori), Dr Stella say be Cameroon citizen wey train for neighbour kontri Nigeria and she enta America for 1992. She also tok say she don dey US for "30 years".

  • Her full name na Stella Gwandiku-Ambe Immanuel and she be around 55 years oldCovid-19 'na diabolic spiritual battle' - Dr Stella Immanuel tok, as more informate about her biography don comot
  • Attend Cameroon Protestant College wey be boarding secondary school for Bali, Northwest of Cameroon
  • Study medicine for University of Calabar (class of 1990)
  • According to her, she move to US for 1992
  • She get daughter wey also train as doctor, she graduate from Baylor University and University of Westminster
  • Begin career Paediatric Clinic for Louisiana
  • According to document of one court case, around 2006 she operate and own Rapha Medical and Therapeutic Clinic for Lousiana
  • She be pastor and founder of Fire Power Ministries for Houston, Texas. According to dia social media profile, dem dey do "deliverance, prayer and spiritual warfare"
  • She don write 5 books wey dey Amazon under di name Dr Stella Immanuel
  • She also write one book wit oda pastors of Nigeria-based Mountain of Fire Ministries church and anoda book under her former name "Stella Gwandiku-Tita"
  • For 2019 she begin work for Rehoboth Medical Centre, wey she also own

You fit read oda beta tori dem here:

Wetin we call dis Video, Hydroxychloroquine fit protect you from COVID-19?