Dr Stella Immanuel doctor video: Twitter penalize Donald Trump Jr for sharing Houston Texas doctor wey promote hydroxychloroquine video for Covid-19 treatment

Dr. Stella Immanuel: Twitter penalize Donald Trump for hydroxychloroquine video

Wia dis foto come from, Twitter

Wetin we call dis foto, Donald Trump Jr
    • Author, Damilola Banjo
    • Role, Broadcast Journalist, Pidgin Service, Lagos

Twitter on Tuesday don penalize Donald Trump Jr., son of di President of United State, sake of say im post fake tori about hydroxychloroquine.

Evidence no dey say di drug fit fight di virus, and regulators warn say e fit cause heart problems.

Di social networking service giant say dem take di action sake of dia stand against fake news and news wey no too pure for dia platform.

Twitter tok say dem order di president son to delete di fake news. Di platform add say dem "limit some account functionality for 12 hours."

Trump Jr. bin share di video wey Dr. Stalle Immanuel and oda doctor dey promote say make pipo use hydroxychloroquine drug to cure coronavirus.

Foto of message wey Twitter send

Wia dis foto come from, Twitter

World Health Organisation (WHO) don tok say di drug no dey cure coronavirus and say to use am too much fit cause harm for person bodi.

Twitter tok say Trump Jr. fit still use im direct message tok to followers, but e n go fit tweet, retweet or like oda tweets during di 12-hour restriction wey dem put am.

Di tweet of Trump Jr. now dey say, "Dis Tweet no longer dey available sake of say e violate Twitter Rules."

Earlier, Twitter don remove di video of di Dr. Immanuel, and delete plenty tweets wey di US president Trump share. Dem add for dis trending topic di risk wey dey hydroxychloroquine.

Andy Surabian, wey be di tok tok person of Trump Jr., say di restriction na to "further proof say Big Tech dey intentional to kill free expression online and e be anoda instance of dem committing election interference to make am difficult for Republican to tok."