Dr Stella Immanuel biography: Doctor in hydroxychloroquine video wey Facebook & Twitter delete bin declare say Covid-19 pandemic na diabolic spiritual battle inside America Frontline Doctors video

Dr Stella Immanuel biography

Wia dis foto come from, Facebook/YouTube

Wetin we call dis foto, Dr Stella Immanuel
    • Author, Olubunmi Okunnu
    • Role, Broadcast Journalist
  • Read am in 4 mins

Informate don dey comot about who Dr Stella Immanuel be, why she comot to tok about hydroxychloroquine and who di group wey she bin dey wit be.

Earlier, we bin report say big-big social media companies like Facebook and Twitter don comot one trending video of Dr Stella wia she tok about how she treat pipo wit hydroxychloroquine, di melecine wey World Health Organisation declare say no dey work ontop Covid-19 patients.

But BBC Pidgin don torchlight one oda video ontop YouTube wey be like di part two of press conference wey Dr Stella and some oda doctors bin show for.

Di video show different-different doctors comot to tok including Dr Stella wey introduce herself as pastor and "God warrior princess".

"Dis disease, dis pandemic big pass Gilead, e big pass democrats and republicans, na diabolic, spiritual battle. And sometimes we need to fight spiritual battles spiritually," Dr Stella bin declare.

"Di pipo behind am na pipo wey no get di good of humanity for mind".

Skip YouTube post
Allow Google YouTube content?

Dis article contain content wey Google YouTube provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Google YouTube cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of YouTube post

Who Dr Stella Immanuel be?

Inside di part two of di conference video wey trend (e dey available as di time we write dis tori), Dr Stella say she be Cameroon citizen wey train for neighbour kontri Nigeria and she enta America for 1992. She also tok say she don dey US for "30 years".

  • Her full name na Stella Gwandiku-Ambe Immanuel
  • E no dey clear how old she be but some records show say she fit be 55 years
  • Attend Cameroon Protestant College (CPC) wey be boarding secondary school for Bali, Northwest Cameroon
  • Study medicine for University of Calabar (class of 1990)
  • According to her, she move to America for 1992
  • She get daughter wey also train as doctor; di pikin graduate from Baylor University and University of Westminster
  • She begin her career one Paediatric Clinic for Louisiana
  • According to one court case for 2006, document show say she operate and own Rapha Medical and Therapeutic Clinic for Louisiana
  • She be pastor and founder of Fire Power Ministries for Houston, Texas. According to di church social media profile, dem dey do "deliverance, prayer and spiritual warfare"
  • She don write five books wey dey Amazon under di name "Dr Stella Immanuel"
  • She also write one book wit some pastors of Nigeria-based Mountain of Fire Ministries church; And anoda book under her former name "Stella Gwandiku-Tita"
  • Around 2019, she begin work for Rehoboth Medical Centre - her own company
Dr Stella Immanuel biography

Wia dis foto come from, Facebook/DrStella

Wetin we call dis foto, Facebook profile of Dr Stella Immanuel

America Frontline Doctors

Di doctors dem wey tanda wit Dr Stella Immanuel call demsef America Frontline Doctors (AGF) and dem be group of medical professionals wey dey take strong eye look wetin oda scientists don agree about di pandemic.

E be like say Dr Immanuel follow as dia member, as she wear coat wit di join-bodi logo and tok for di conference wey dem organise on 27 July.

Dr Stella Immanuel biography: Website of America Frontline Doctors

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, Earlier on 28 July di website of America Frontline Doctors bin dey work, but by afternoon e don disappear wit dia videos join

Tea Party Patriots, wey be conservative political join-bodi wey dey push for President Trump re-election, tanda gidigba to give di conference support.

For May, America Frontline Doctors founder Simone Gold, bin organise letter to Oga Trump wia im ask am to end di lockdown rules.

Ralph Norman, wey bi Republican member of di House of Representatives, bin dey wit di doctors wen dem deliver dia press conference wey tok about di success of hydroxychloroquine as treatment of dia Covid-19 patients.

Hydroxychloroquine conspiracy dey?

For dia conference, one AGF medical doctor accuse big pharmaceutical companies say dem dey fear to lose money because dem sabi say hydroxychloroquine dey work.

"We don hear of study wey dem do for Nigeria, India, Portugal, Italy wia dem use am [hydroxychloroquine] as prevention, e work for everi case and e especially work wen dem use am early... na wetin dey fear dis companies be dat... dem go lose plenty money," Dr Richard Urso bin tok.

Plenty serious debate don dey ontop social media recently about hydroxychloroquine. World Health Organisation don tok say dem torchlight say di melecine no work for Covid-19.

Di debate ginger sotey e divide Americans ontop politics, as those wey support hydroxychloroquine say President Trump support am, and those wey no want Trump na di pipo wey no want make di world sabi say di melecine wey work.

Dr Stella Immanuel biography

Wia dis foto come from, YouTube/AGF

Wetin we call dis foto, Dr Stella Immanuel

How big social media companies react

For statement to BBC News, Twitter say: "Tweets wit di video dey in violation of our Covid-19 misinformation policy. We are taking action in line with our policy here."

"We don remove dis video for sharing false information about cures and treatments for Covid-19," Facebook tell BBC, confaming say e ey also remove oda versions of di video.

YouTube tell BBC: "We don remove di video for violating our Covid-19 misinformation policies."

BBC News also approach Breitbart, di White House and America's Frontline Doctors for comment.