Ghanaian boxer ‘Royal Storm’ Dogboe be new WBO Super Bantamweight Champion

Isaac Dogboe

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Isaac Dogboe don fight for eighteen matches, no lose any and don use TKO win 13
Read am in 1 mins

23 year-old Ghanaian boxer Isaac Dogboe be di new WBO World Super Bantamweight champion after he knock out American Jessie Magdaleno for Philadelphia, Sunday morning.

Dogboe en punches enter di American boxer en system hard, by round 11 Magdaleno no dey see wɛ!

Di 'Royal Storm' make he storm di canvass top twice, finally referee stop di match.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

For dis fight inside alone, Dogboe storm Magdaleno plus 3 heavy knocks wey send go di American en system.

Dogboe dominate di match but before he go find en level, di former title holder Magdaleno give am some strong punch for di first round inside, Dogboe fall ground. But di Ghanaian boxer recover quick quick.

After Dogboe en recovery, he manage control di bout, deliver more punches on Magdaleno as he receive less from di American.

For di score cards top, Dogboe dey ahead on all three, he record 97-91, 96-91 den 95-93 as at stoppage time.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Di two boxers embrace demsef afta di match but not before Dogboe run go meet im papa to hug am.

23-year-old Dogboe after winning di WBO World Super Bantamweight title turn Ghana's youngest world champion ever, he broke former Ghanaian boxing great, Ike Quartey en record who chop first World championship at age 25.