Anthony Joshua: Di one tin wey remain for am

Anthony Joshua with four heavyweight title belts.

Wia dis foto come from, lawrence lustig

Read am in 1 mins

British-Nigerian boxer Anthony Joshua beat Joseph Parker inside boxing match for one world heavyweight title on Saturday for Cardiff.

Na points Joshua use win di match with score of 118-110 118-110 119-109 as referee dem take see di fight.

Di 28 year old Joshua use im left hand throughout di match to tackle Parker wey try well-well to endure am.

Anthony Joshua vs Joseph Parker.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Dis na Joshua heavyweight title number 4

Wetin remain now for Anthony Joshua

Di world heavyweight titles wey Joshua get now na four - WBA, IBF, WBO and IBO. Im be di first person to reach dis kain level for world of boxing after Mike Tyson and Lenox Lewis.

But to be di main di main Baba for boxing for di whole world, wey be undisputed champion, Joshua go get to fight Deontay Wilder next. Wilder na im hold di WBC belt and e don tey wey Joshua dey put eye for dat one.

From di video wey Wilder post for im social media, e be like say im dey redi for Joshua.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post