Ghana: Isaac Dogboe fight make people belle sweet

Isaac Dogboe

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Isaac Dogboe never lose any of di 18 matches wey im don fight, and e use Technical Knock Out win 13 matches
Read am in 2 mins

Di way Ghanaian boxer Isaac Dogboe beat Cesar Juarez to win di Junior Featherweight World Title don make Ghanaians happy sotey some of dem say dem no vex again to pay TV license.

Dogboe face di Mexican for ring inside di Bukom boxing arena for Accra on 6 January - na di first correct boxing match dem go get for Ghana for 2018.

Na Technical Knock Out (TKO) na im Dogboe sama Juarez for fifth round of di match to win di title.

Oheneba Kweku Idun joke for social media say "now I feel like I fit pay my TV licence after I watch di Dogbe fight."

Skip Facebook post, 1

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post, 1

But even as Ghanaians dey jolly on top di fight, dem dey vex for stations wey no show di game. For Twitter, one person dey ask wetin dem dey use di TV license fee wey dem wan collect do as dem no show di match:

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Dis person ask whether one station dey show Nigerian juju film sotay dem no show di match.

Skip Facebook post, 2

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post, 2

Anoda one use social media to name local station wey im say bin wan show di match and last-last no show am:

Skip Facebook post, 3

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post, 3

All in all, Ghanaians agree say di match na better way to enter di year; like dis viewer wey say di knock out punch wey Dogboe give Juarez fit turn di economy around.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Meanwhile, dia guy Dogboe don already dey look for im next title; im announce for social media say im wan be di next full WBO Super Bantamweight World Champion:

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 3