Beyoncé join Jay-Z, Rihanna and odas for di billionaire club as fifth musician to do so

Wia dis foto come from, EPA-EFE/REX/Shutterstock
- Author, Pritti Mistry
- Role, Business reporter
- Read am in 4 mins
Beyoncé na di fifth musician wey go become billionaire as e join Jay-Z, Swift, Bruce Springsteen and Rihanna to become di world wealthiest pipo, according to Forbes.
Di American star don join di elite group of musicians wit 10-figure fortunes, Forbes report, Taylor Swift, Rihanna, Bruce Springsteen and her husband Jay-Z dey di list di list, wey di magazine publish.
Earlier dis month, Forbes estimate Beyoncé net worth as $800m (£593m) and dem predict say she go cross di billionaire threshold for di first time afta years of success.
Her 2023 Renaissance World Tour make am almost $600m, dis make her and Taylor Swift as one of di biggest pop music icons for di world.
Beyoncé produce feem for her concert performance, dis na her first solo tour afta seven years, and she distribute am directly through one deal wit AMC theater chain, she pocket $44m (£33m) wey she make according to di global box office gross from di feem.
Her 2024 album Cowboy Carter, wey celebrate and show di black roots of country music, win di album of di year for Grammy Awards - na di first time Beyoncé go win dat prestigious award, even though dem don nominate her four times.
Forbes estimate di Cowboy Carter tour - wey get guest appearances from Jay-Z, two of dia three pikin and former Destiny Child mates - make more dan $400m in ticket sales and anoda $50m in merchandise wey dem sell for di shows.
While di tour break ticket records for Tottenham Hotspur Stadium in London and Stade De France for Paris, e still get slow ticket sales wey make promoters slash some prices to fill seats.
However, na still di highest top-priced ticket for any artist wey go visit UK in 2025, and e cost £950, while di cheapest na £71.
One special halftime show for Netflix first Christmas Day NFL game make around $50m, plus $10m for Levi commercials, Forbes tok.
Bloomberg, wey get im own billionaire index, carry Selena Gomez join dia list of musicians - wit net worth of $1.3bn (£962m) in 2024.
But Forbes dey argue dis figure, dem estimate say Gomez worth $700m (£518m).
How Beyonce take become billionaire?

Wia dis foto come from, Justin Sullivan/Getty Images
Di 44-year-old mother of three rise financially afta her big breakthrough in di entertainment industry.
Beyonce start her career in di late 1990s wen she dey part of di best-selling R&B girl group (Destiny's Child) but she later break from di group and start her solo debut for 2003 wit di album, "Dangerously in Love."
Afta Destiny's Child break up for 2005, Beyoncé release "B'Day" for 2006 and follow am wit "Dreamgirls" dat same year.
Beyoncé na one of di big fish for di industry wit 35 Grammy wins and 99 nominations, na she be di most awarded artiste in di history of di awards, including di ones wey she win wit di Destiny's Child, girl group wey help start her career in di music industry.
She marry rapper Jay-Z, and dem get three children togeda. Throughout di 2000s, Beyoncé get plenty Billboard placement wey help her rise as household name in di music industry.
She headline Coachella 2018 wit "Homecoming," wey Netflix produce as documentary wia she earn around $600 million.
Apart from being a musician, Beyoncé na business mogul. She get cloth and hair care lines, and she don enta drink business wit whisky brand wey she name afta her great-grandpapa, SirDavis.
Beyoncé also get her own company, Parkwood Entertainment wey she start for 2010. she dey manage and produce her own music, documentaries, and concerts.









