Hezbollah announce Naim Qassem as dia new leader

Qassem, man wit beard dey look camera

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, File photo of Qassem for one memorial service for one senior Hezbollah commander for June
    • Author, Jacqueline Howard
    • Role, BBC News
    • Reporting from, London
  • Read am in 3 mins

Hezbollah don announce say di group deputy secretary general go become dia new head.

Naim Qassem go replace long-term leader Hassan Nasrallah, wey die for one Israeli air strike for Beirut for September.

E be one of di few senior Hezbollah leaders wey still dey alive, afta Israel kill most of di group leadership for one series of attacks.

Di appointment dey come as di conflict for Lebanon increase in recent weeks.

For more dan 30 years, Naim Qassem bin serve as Hezbollah deputy secretary general and one of di group most recognised faces.

Hezbollah tok say na di Shura Council elect am in accordance wit di group rules. Im whereabouts no dey clear, however some reports suggest say e don run go Iran, wey be Hezbollah main supporter.

Announcing Qassem promotion, Hezbollah release one statement wey describe am as "bearing di blessed banner for dis march".

Di statement also honour di late Nasrallah and odas wey die for di conflict.

Dem suppose pass di new Hezbollah leadership to cleric Hashem Safieddine, but on 22 October, dem reveal say e die for one Israeli air strike nearly three weeks earlier.

Israel bin carry out air strikes across Lebanon in recent weeks, and dem target wetin dem say na Hezbollah operatives, infrastructure and weapons.

On Monday night, di Israeli military bin carry out air strikes for Lebanon eastern Bekaa Valley, one area where Hezbollah get strong presence.

Lebanese health ministry say at least 60 pipo don die and more dan 50 injure.

Di Israeli military neva comment on di attack.

Israel bin start offensive against Hezbollah afta almost a year of cross-border hostilities wey happun sake of di war for Gaza.

Dem say dem wan ensure di safe return of residents of border areas wey Hezbollah rocket, missile and drone attacks displace.

Over di past year, more dan 2,700 pipo doin die and nearly 12,500 pipo dey injured for Lebanon, according to di kontri health ministry.

Hezbollah attack Israel wit thousands of rockets and drones ova di same period, and at least 59 pipo die for northern Israel plus di occupied Golan Heights.