Who be Hashem Safieddine wey fit replace Hezbollah leader Hassan Nasrallah wey Israel kill

Hassan Nasrallah (L) and Hashem Safieddine (R)

Wia dis foto come from, Getty Images/Reuters

Wetin we call dis foto, Hassan Nasrallah (L) and Hashem Safieddine (R)
    • Author, David Gritten
    • Role, BBC News
  • Read am in 7 mins

Sheikh Hassan Nasrallah, di leader of Lebanon militant Shia Islamist Hezbollah movement, na one of di best known and most influential figures in di Middle East.

Dem neva see Nasrallah in public for years becos of fear of assassination by Israel.

And on Saturday, Israeli military tok say dem don kill Nasrallah for di overnight strike on Beirut.

Hezbollah don confam di death of dia leader.

Di group say dia leader Nasrallah don 'pass away' for one raid wey happun for southern suburb.

"His Eminence, di Master of Resistance, di righteous servant, don pass away to be wit im Lord," di statement tok.

Di group also "pledge" to fight against Israel and continue dia support for "Gaza and Palestine, and to defend Lebanon and di steadfast and honourable pipo".

One dark figure wit close personal links to Iran, e dey play key role in turning Hezbollah into di political and military force e become today - and remain respected by di group supporters.

Under Nasrallah leadership, Hezbollah don help train fighters from di Palestinian armed group Hamas, as well as militias in Iraq and Yemen, and obtain missiles and rockets from Iran for use against Israel.

E bin steer Hezbollah evolution from a militia founded to fight Israeli troops wey bin dey occupy Lebanon into a military force stronger dan di Lebanese army.

Who be Hashem Safieddine, Hezbollah possible new leader?

Hashem Safieddine

Wia dis foto come from, Getty Images

Wit di killing of Hassan Nasrallah, attention now dey on di man wey many dey believe say go inherit im position, Hashem Safieddine, tori pipo Reuters report.

Dis na some tins you need to know about Safieddine, wey one source tell Reuters say im survive di Israeli attacks.

Safieddine na head of di executive council, im dey oversee Hezbollah political affairs.

Im also dey for di Jihad Council, wey dey manage di group military operations.

Safieddine na Nasrallah cousin and like am, im na man of God wey dey wear black turban wey be symbol to show say im na descent of Prophet Mohammed.

For 2017, U.S. State Department list am as terrorist and for June im threaten big escalation against Israel afta dem kill anoda Hezbollah commander.

"Make (di enemy) prepare imsef to cry and wail," im tok for di burial.

Safieddine public statements dey usually show Hezbollah militant position and wia dem stand on Palestine mata.

For one recent event for Dahieh, Hezbollah stronghold for Beirut southern suburbs, im bin declare, "Our history, our guns and our rockets dey wit you," in solidarity wit Palestinian fighters.

Nasrallah "bin start to arrange positions for am inside different kain of councils inside Lebanese Hezbollah. Some of dem bin no too clear like di odas. Dem allow am come, go out and speak," Phillip Smyth, expert wey dey study Shi-ite militias, tok.

Safieddine family connections plus im physical resemblance to Nasrallah, as well as im religious status as descendant of Mohammed, go favour am.

Im bin also dey loud on im criticism of U.S. policy.

In response to American pressure on Hezbollah, im say for 2017, "Dis mentally impeded, crazy U.S. administration wey Trump dey head no go fit harm di resistance," and add say, dat kain action go only strengthen Hezbollah decision.

Hassan Nasrallah profile

Hassan Nasrallahdey deliver speech on camera

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Hassan Nasrallah don dey in charge of Hezbollah for three decades

Dem born Hassan Nasrallah for 1960 and e grow for Beirut eastern Bourj Hammoud neighbourhood, wia im papa Abdul Karim run small greengrocers.

Na im be di eldest of nine children.

Im join di Amal movement, den Shia militia, afta Lebanon fall into civil war for 1975. Afta short spell in di Iraqi holy city of Najaf to attend Shia seminary, e rejoin Amal for Lebanon bifor im and odas comot from di group for 1982, shortly afta Israel bin invade Lebanon in response to attack by Palestinian militants.

Di new group, Islamic Amal, receive considerable military and organisational support from Iran Revolutionary Guards based in di Bekaa Valley, and di most prominent and effective of di Shia militias wey later form Hezbollah.

For 1985, Hezbollah officially announce dia establishment by publishing "open letter" wey identify di US and di Soviet Union as Islam principal enemies and call for di "removal" of Israel, wey dem tok say e dey occupy Muslim lands.

Nasrallah work im way up through Hezbollah ranks as di organisation grow. E tok say afta e serve as fighter e become di director in Baalbek, den di whole Bekaa region, followed by Beirut.

E become leader of Hezbollah for 1992 at di age of 32, afta dem kill im predecessor Abbas al-Musawi inside on Israeli helicopter strike.

One of im first actions na to retaliate to di killing of Musawi. E order rocket attack into northern Israel wey kill one girl, dem kill one Israeli security officer at di Israeli embassy in Turkey by car bomb and suicide bomber strike di Israeli embassy for Buenos Aires, Argentina, and kill 29 pipo.

Nasrallah also manage low-intensity war wit Israeli forces wey end wit dia withdrawal from southern Lebanon for 2000, though im suffer di lost of im eldest son Hadi wey die in firefight wit Israeli troops.

Following di withdrawal Nasrallah proclaim say Hezbollah don achieve di first Arab victory against Israel. E also promise say Hezbollah no go scata, and tok say "dem must restore all Lebanese territory", including di Shebaa Farms area.

Some calm bin dey until 2006, wen Hezbollah militants launch cross-border attack wia eight Israeli soldiers die and dem kidnap two odas, causing massive Israeli response.

Israeli warplanes bomb Hezbollah strongholds in di South and for Beirut southern suburbs, while Hezbollah fire about 4,000 rockets at Israel. More dan 1,125 Lebanese, most of dem civilians, die during di 34-day conflict, as well as 119 Israeli soldiers and 45 civilians.

Nasrallah home and offices dey targeted by Israel warplanes, but e survive untouched.

For 2009, Nasrallah issue new political manifesto wey seek to highlight Hezbollah "political vision". Dem drop di reference to one Islamic republic wey dem establish in di 1985 document, but maintain tough line against Israel and di US and reiterate say Hezbollah need to keep im weapons despite UN resolution wey ban dem in southern Lebanon.

"Pipo dey change. Di whole world change ova di past 24 years. Lebanon change. Di world order change," Nasrallah tok.

Four years later, Nasrallah declare say Hezbollah dey enta "completely new phase" of dia existence by sending fighters into Syria to help dia Iran-backed ally, President Bashar al-Assad, put down rebellion. "Na our battle, and we dey up to am," e tok.

Lebanese Sunni leaders accuse Hezbollah of dragging di kontri into Syria war and sectarian tensions worsen dramatically.

For 2019, deep economic crisis for Lebanon trigger mass protests against political elite long accused of corruption, waste, mismanagement and negligence. Nasrallah initially express sympathy wit di calls for reforms, but im attitude change as di protesters begin demand for complete rebuild of di political system.

On 8 October 2023 - di day afta di unprecedented attack on Israel by Hamas gunmen wey cause di war for Gaza - previously sporadic fighting between Hezbollah and Israel escalate.

Hezbollah fire at Israeli positions, in solidarity wit di Palestinians.

For one speech for November, Nasrallah tok say di Hamas attack na "100 percent Palestinian in terms of both decision and execution" but di firing between im group and Israel dey "veri important and significant".

Di group launch more dan 8,000 rockets at northern Israel and di Israeli-occupy Golan Heights. Dem also fire anti-tank missiles at armoured vehicles and attack military targets wit explosive drones.

Di Israel Defense Forces (IDF) retaliate wit air strikes and tank and artillery fire against Hezbollah positions for Lebanon.

During one recent speech, Nasrallah blame Israel for detonating thousands of pagers and radio handsets wey Hezbollah members dey use, e kill 39 pipo and injure thousands more, and e tok say dem don "cross all red lines". E acknowledge say di group don suffer "unprecedented blow".

E no too tey bifor Israel dramatically begin attack Hezbollah and launch waves of bombing wey nearly kill 800 pipo.