Tinubu withdraw posting of former govnor of Kebbi State as ambassador to Turkey

Wia dis foto come from, Kebbi State government
Di Presidency don withdraw di name of former Kebbi State guvnor Usman Dakingari wey dem bin announce on Thursday as di new ambassador designate to Turkey.
Bayo Onanuga wey be di tok-tok pesin for President Bola Tinubu bin publish a statement wia e tok say di President don approve di names of four pipo as ambassador designates to di United States of America, di United Kingdom, France and Turkey.
Ayodele Oke na di ambassador-designate to France, Lateef Are na di pesin for di US; Amin Dalhatu na for di UK, while Usman Dakingari na for Turkey, according to dat statement.
Tinubu also direct di Ministry of Foreign Affair "to notify di govments of di kontris about di ambassadors-designate, in accordance wit diplomatic procedures".
Howeva, dis Friday morning anoda statement come out from di presidency wey tok say "President Tinubu don approve di posting of three ambassadors-designate, no ambassador for Turkey yet".
Di statement also dey signed by Bayo Onanuga, but e no give any reason why di name of Dakingari no longer dey dia.
Dis development dey come as President Tinubu dey embark on a state visit to Turkey dis weekend.
Remember say President Tinubu bin appoint nominate 68 Nigerians including some names wey pipo describe as controversial like former presidential tok-tok pesin Reno Omokri and former aviation minister Femi Fani Kayode.
Di Nigerian senate don conclude di screening of di nominees since, but di president neva assign dem to di kontris wia dem go work.
Who be Musa Dakingari?
Oga Dakingari serve as di guvnor of Kebbi State from 2007 to 2015 for di platform of di Peoples Democratic Party (PDP).
Im na graduate of Ahmadu Bello University Zaria wia e bin study Geography and graduate for 1984.
E bin start im professional career as Town Planning Officer for di Sokoto State Ministry of Works and Housing for 1985 bifor e later join di Nigerian Customs Service four years later.









