FBI release fotos of 'person of interest' as manhunt for Trump ally Charlie Kirk killer continue

FBI release foto of 'person of interest' in Kirk killing

Wia dis foto come from, FBI

Read am in 5 mins

Federal Bureau of Investigation (FBI) for Salt Lake City don release fotos of one "person of interest" for di shooting of Charlie Kirk wey happun on Wednesday, 10 September.

Dem say make di public help dem identify di pesin. Dis na di first images di law enforcement don release of di individual dem believe fit dey involved for Kirk death.

Di killer still dey at large, and earlier, di police bin question two pipo but dem don release dem.

For one news conference, authorities say e be like di shooter bin dey ontop roof, bifor e run from di scene for Utah Valley University.

Authorities don also locate wetin dem believe to be di weapon di suspect use for di shooting.

Dem also say e be like say di suspect wey kill conservative influencer Charlie Kirk for Utah Valley University on Wednesday dey of "college age", investigators tok.

Dem say dem don track di suspect movements as e jump from one roof afta di shooting and run from di campus go one neighbourhood.

Dem shoot Kirk, wey start conservative youth political group Turning Point USA, for neck on campus, as e dey follow students tok.

Di officials add say dem dey "confident in our abilities" to track di shooter as dem get "good video footage" of di suspect.

Apart from di high-powered rifle dem see, officials say dem also see one "footwear impression, one palm print and forearm imprints" wey dem currently dey analyse.

Dem also say dem don track di shooter movements directly bifor and afta di shooting.

Di officials say dem don already visit di neighbourhoods wia dem believe say di shooter pass through, dem say dem don contact witnesses plus pipo wit doorbell cameras.

Wetin we call dis Video, Watch: "Dark moment for America", Trump says after killing of Charlie Kirk

Search for who shoot Charlie Kirk wey be conservative commentator and podcast host wit millions of followers and ally of US President Donald Trump dey go on.

Officials believe say dem shoot am from roof, according to BBC Verify wey check video wey pipo tok say fit show di gunman.

Dem shoot influential Republican activist Kirk for one event for Utah Valley University on Wednesday evening.

Kirk na ogbonge supporter of President Donald Trump, and e be di founder of Turning Point USA, organisation wey dey seek to spread conservative ideas to students for US campuses.

Trump for im official announcement tok say na dark moment for America.

E show say Trump dey vex while e dey pay tribute to di deceased, as e describe Charlie Kirk as martyr for truth and freedom.

Trump directly blame radical left-wing politics say dem contribute to di atrocity and oda recent violent political attacks.

Many senior politicians, both Democrats and Republicans, don respond say dis kain violence no get place for American democracy.

However, dem go close Utah Valley University until Monday as dem suspend all classes, both in-person and virtual.

For dia statement, di university say dem dey "shocked and saddened by di tragic passing", of Charlie Kirk, wey bin dey speak for dia campus bifor dem shoot am.

Wetin to know and how di shooting of Charlie Kirk take waka

Kirk bin arrive for di campus event as part of im "American Comeback" tour wey dey scheduled to stop for 15 college campuses for di US.

At about 12:20, dem shoot Kirk. Police bin first say di shooter fire from about 182m (200 yards) away, but e appear say di figure for di roof dey approximately 130m (142 yards) from wia Kirk bin dey sit.

Police confam say pesin fire shots at Kirk during di event for Utah Valley University, and dem tell students make dem leave campus "immediately" and until further notice.

By afternoon, US President Donald Trump announce say Kirk don die sake of injuries.

Trump order make dem fly flags for half-mast for US to honour di conservative activist.

Meanwhile, di FBI director Kash Patel bin say one "subject" dey for custody, but later add say dem don release di two suspects wey dem first arrest.

Trump post video message for im Truth Social platform, say e dey "filled wit grief and anger" afta di "wicked assassination" of Kirk.

E promise say e no go gree for political violence, as dem continue to dey search for di suspected shooter.

Na single shot di shooter bin fire towards Kirk around 12:20 (19:20 BST) local time yesterday as e dey address crowd while e seat for stage.

Di FBI dey co-lead di investigation wit di Utah Department of Public Safety.

Department of Public Safety say dem dey work at "multiple active crime scenes" wey dey identified based on wia dem shoot Kirk "as well as di locations wia di suspect and victim travel".

Di department add say six local police officers dey work for di event, alongside Kirk security detail.

Who be Charlie Kirk?

Charlie Kirk na one of di highest profile conservative activists and media personalities for di US and trusted ally of President Donald Trump.

Dem shoot am on Wednesday at di age of 31 while e dey host college event for Turning Point USA, di organisation wey e co-found.

Im wife and family bin also dey di scene but dem dey safe; no oda injuries dey reported.

Kirk na di son of architect wey grow up for di well-to-do Chicago suburb of Prospect Heights.

E attend community college near Chicago bifor e drop out to devote imsef to political activism.

Kirk start Turning Point USA for di age of 18, wit di aim to spread conservative ideals for liberal-leaning US colleges.

Di organisation play key role for di get-out-di-vote effort for Trump and oda Republican candidates for last year election.

E dey widely credited say e help to register tens of thousands of new voters and direct Arizona for Trump.

'Bad violence': Former US presidents condemn Charlie shooting

Former US presidents don dey react afta Donald Trump confam di death of Charlie Kirk.

Joe Biden say e and im wife, Jill, dey pray for Kirk family and loved ones. Di kontri 46th president say "no place" dey for di US for dis kain violence.

Barack Obama echo Biden words, as e describe di shooting as "despicable violence" wey "no get place for our democracy."

For statement to BBC News, George W Bush say Kirk dey "murdered for cold blood" for college campus, wia "ideas suppose dey sacrosanct".