Bye bye!
Dis na wia we draw di curtain of today live tori dem from around di world.
We go see you again next time.
Live update of latest tori dem from around di world.
Tunde Ososanya, Victor Ezeama
Dis na wia we draw di curtain of today live tori dem from around di world.
We go see you again next time.

Wia dis foto come from, AFDB
Former Minister of Agriculture Development for Nigeria, and di current President of di African Development Bank Group, Akinwumi Adesina, don criticise di decision of di Nigeria goment to open dia border and allow massive food importation in order to stop di increase in price of food for di kontri.
Adesina, wey tok dis one for one retreat of African Primates of di Anglican Church for Abuja, say di policy dey "depressing", and e fit destroy Nigeria Agricultural sector becos e fit undermine all di hard work and private investments wey don go into di sector.
“Nigeria no fit dey rely on di importation of food to stabilise prices. Nigeria suppose dey produce more food to stabilise food prices, while creating jobs and reducing foreign exchange spending, dat one go further help stabilise di Naira,” e tok.
“Nigeria no go fit import im way out of food insecurity. Nigeria no suppose turn into a food import-dependent nation.”
"Nigeria must to feed imsef wit pride. A nation wey dey depend on odas to feed imself, dey independent only for name.”
Adesina reaction na sake of di announcement wey di goment bin make on 10 July say dem go suspend duties, tariffs, and taxes on di importation of maize, husked brown rice, wheat, and cowpeas through di land and sea borders, for 150 days.

Wia dis foto come from, Reuters
Corey Comperatore, a husband and father of two, bin die as e dey try to protect im family for di attempted assassination of Donald Trump on Saturday.
Di 50-year-old na volunteer fire chief, and according to im social media profiles, e bin work as a project and tooling engineer for one plastic manufacturing company.
Comperatore na strong Trump supporter, and im bin attend di rally near Pittsburgh, Pennsylvania, wey dey about 12 miles from im home.
Im daughter Allyson write for social media and tok say im na "di best dad a girl fit eva ask for" and say e "died a real-life superhero".
"E throw my mum and I to di ground... [and] cova bodi from di bullet wey come at us," she tok, as she describe di moment of di shooting.
For interviews, neighbours and friends describe Comperatore as a good man wey bin dey play active role for im community.
Pennsylvania Govnor Josh Shapiro tok say Comperatore "die as a hero".
A GoFundMe wey dem set up for im family don already raise more dan $830,000 (£640,000).

Wia dis foto come from, Reuters
As we don dey report on dis Donald Trump assassination attempt, di high school rifle team wia di 20-year-old gunman wia police don shoot to death bin dey attend, don reject am.
One of im classmate tok ABC news say dem warn Crooks say make im no return to di team afta one preseason session.
"Im no qualify for di team, dem tok am say make im no come back sake of im shooting dey bad, na dangerous one," Jameson Myers tok.
Anoda pesin wia dey inside di team don remember how Thomas Crook "shoot bad" wia "im no fit for di rifle team".
Di school district tok say dey no get any record of Crooks as im dey try out for di team wia im "neva appear on top roster".
Crooks bin dey part of one local shooting club - di Clairton Sportsmen's Club - for at least one year.

Di Inspector General of Police, Kayode Egbetokun don order make dem suspend di proposed enforcement of di Electronic Central Motor Registry Information System (e-CMR) wey bin suppose start on 29 July, 2024.
Di tok-tok pesin for di Police, Muyiwa Adejobi, explain say dem suspend di enforcement exercise, so dat dem go do more enlightenment to tell pipo di benefits and importance of di e-CMR initiative.
According to im, di process dey designed to ensure di safety and security of all types of vehicles and even motorcycles.
Wen di car owners input dia data for di system, di police go den use di data to flag di vehicles if sombodi steal am for instance.
Adejobi explain say di e-CMR no be revenue-generating platform, but na initiative to digitalise policing for effectiveness and general safety of lives and property of Nigeria pipo.
Pipo fit get di digitalised CMR certificate online.
Di IGP warn police officers to stop to dey request for e-CMR certificates from vehicle owners, or to dey use am to dey collect moni from pipo.
Any officer wey dem catch as e dey extort or exploit members of di public under di guise of say dem no get e-CMR certificate, go face appropriate sanctions, police tok.

Wia dis foto come from, Reuters
We go continue to dey bring you updates bifor we close dis live page.

Wia dis foto come from, BBC/Mohamud Abdisamad
Several pipo don die afta one car bomb explod outside one popular café wey full wit football fans for di Somali capital, Mogadishu.
Di bomb bin go off on Sunday night at 22:28 local time as patrons at Top Coffee bin dey watch di Euro 2024 football final between Spain and England.
Police tok say at least five pipo die for di explosion and 20 more injure. Security sources late tell di AFP news agency di death toll don rise to nine.
Jihadist group al-Shabab say na dem carry out di attack.
Di restaurant bin full, and some dey on di pavement outside as di bomb go off, and send pipo dey run for safety, witnesses tok.
"We bin hear a loud, horrifying explosion during di first half of di game wey we bin dey watch. Evri one gatz figure out how to save demsefs,” one of di survivors, Mohamed Muse, tell di BBC.
"I see pipo in danger, injured pipo screaming for help, and odas dey confused - e bin dey terrifying," e add.
Di explosion also destroy some cars and damage several buildings.

Wia dis foto come from, Getty Images
Former President Donald Trump say im "suppose don die" as e call di assassination attempt a "surreal experience".
"I no suppose dey here, I suppose don die," Trump tok as e speak to di New York Post wen e dey go Milwaukee for di Republican National Convention.
Trump wear a white bandage wey cova im right ear but im aides no allow any photograph to dey taken, di Post tok.
“Di doctor for di hospital tok say im neva see anytin like dis, e call am miracle," Trump add.
Meanwhile, Melania Trump, wife of di former president, don call on Americans to repair political division and focus on love.
In her message, she refer to di man behind di assassination attempt wey shele on Saturday as "monster" and denounce di "violent" attack on im husband life.

Wia dis foto come from, Getty Images
"Wen I watch di violent bullet strike my husband, Donald, I realize my life, and Barron life bin dey on di brink of devastating change," Mrs Trump tok.
"I dey grateful to di brave secret service agents and law enforcement officials wey risk dia own lives to protect my husband."

Wia dis foto come from, CBS
Di FBI don name di man wey shoot at Donald Trump during campaign rally as Thomas Matthew Crooks.
Crooks allegedly open fire while di former US president bin dey address crowd for Butler, Pennsylvania, e leave one audience member dead and two odas dey badly hurt.
Secret Service sniper shoot dead di 20-year-old, officials tok.
For statement, di FBI say Crooks na di “subject wey dey involved” in di assassination attempt on di former president and active investigation dey under way.
Thomas bin no carry any ID, so investigators use DNA to identify am, di FBI tok.
Im bin dey di Bethel Park area for Pennsylvania, wey dey about 70km (43 miles) from Butler, di site of di attempted assassination. Matthew appear to don graduate in 2022 from Bethel Park High School, according to di Pittsburgh Tribune-Review newspaper.
State voter records show say Thomas na registered Republican, according to US media.
Read more here: Tins to sabi about Donald Trump shooter.

Wia dis foto come from, Getty Images
Pipo of Rwanda go vote in dia new president and lawmakers on Monday, 15 July.
Polling stations across di kontri go open across di kontri for di presidential and parliamentary elections as di current President Paul Kagame dey also seek fourth term for office.
Kagame wan extend im 24-year rule for election wey analysts tok say im go win by a landslide.
Im don dominate evri election since become president in 2000, wit ova 90% of di vote. For 2017, Kagame win wit a staggering 99%.

Wia dis foto come from, Getty Images
US President Joe Biden don condemn Saturday assassination attempt on former president Donald Trump as e tok say place no dey for dat kain violence for di kontri.
Biden tok dis one wen im address di nation afta di attempted assassination on im predecessor by 20-year-old Matthew Crooks.
"We no fit go down dis road again. We don travel am bifor for our history," e tok.
Dis na BBC Pidgin live tori dem from around di world.