You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Caf suspend Senegal coach Thiaw, fine dia national team and Morocco football federation ova Afcon final kasala
Di Confederation of African football (Caf) don finally release details of disciplinary action against Senegal and Morocco afta di Afcon 2025 final chaos.
Many football fans and sabi pipo bin dey watch to see wetin Caf go do afta dem chook eye for di confusion wey happun.
Senegal coach Pape Thiaw order im players to comot di park for di last-minute of di final afta di referee award penalty to di host Morocco.
Afta 17 minutes of confusion and drama, Sadio Mane ask im teammates to return to di park and end di game.
Na so Morocco player Brahim Diaz miss di penalty to carry di game to extra time wey Senegal eventually win 1-0.
Caf and Fifa bin condemn di actions of di Senegal players and dia coaching staff about di fact say dem decide to" boycott" di game afta di referee blow whistle for di penalty against dem.
Fifa president Gianni Infantino wey bin dey di stadium to watch di final say wetin Senegal do and di confusion wey happun dey "unacceptable", and call for punishment for all di pipo wey dey involved for di chaos.
Afta weeks of investigation, di Caf disciplinary board don finally release dia decision; dem fine di two teams wey dem also suspend some players wey include Morocco captain Achraf Hakimi.
Caf suspend Pape Thiaw and two players wey dem fine Senegal $615k
Caf disciplinary board suspend Senegal coach Pape Thiaw for five games sake of wetin dem describe as "unsporting conduct" wey violate di code and principles of fair play.
Dem also say wetin Pape Thiaw do "drag di game of football into disrepute".
Di Senegal coach afta di game later apologise for di boycott.
"We no gree wit di penalty decision, dat na why we do dat tin; I no like how I act. I tell di players to leave di pitch dat time sake of I don vex, I apologise to di world of football."
But Caf punish am wey dem also fine di Senegal federation.
- Dem fine Pape Thiaw $100K
- Caf also suspend Senegal player Iliman Ndiaye for two games for "unsporting behaviour" towards di referee
- Ismaila Sarr also chop two game ban for "unsporting behaviour" towards di referee
- Caf fine di Senegal federation $300k for "improper conduct of supporters wey affect di integrity of di game"
- Caf also fine di federation anoda $300K for "unsporting conduct of dia players and technical staff"
- Di federation get anoda $15K for di misconduct of di national team afta five of dia players collect yellow card for dat final game.
Morocco captain Hakimi also chop suspension wey dem fine dia federation $315K
Di host kontri bin file protest to Caf say wetin Senegal do for dat final dey against di rules of football, and say dia boycott affect di morale and mind of dia players wey make Brahim Diaz miss di penalty.
Article 82 of Caf rules tok about di fact say any team wey refuse to play football match or comot di pitch witout authorisation, go lose di game wey dem dey eliminated.
Article 84 say if any team boycott football game like wetin happun for di Afcon final, dem automatically lose di game 3-0, wey dem go award di points to di oda team.
Caf throway di Morocco protest - wey mean say Senegal be di true winner of di 2025 Afcon.
- Caf suspend Hakimi for two games for "unsporting behaviour"
- Dem also suspend Ismael Saibari for three games also for "unsporting behaviour"
- Dem also fine Ismael Saibari $100K
- Caf also fine di Morocco football federation $200K for "inappropriate behaviour of some ball boys during di game"
- Dem fine di federation $100K for improper conduct of dia players and technical staff wey storm di VAR area to stop di referee im work
- Di Morocco football federation also chop anoda $15K fine sake of dia fans use laser during di game
Di two teams get di right to contest di punishment.