You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
All you need sabi about di 2026 UTME registration
Registration for di 2026 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME) for di 2026/2027 academic session into higher institutions for Nigeria go begin on Monday, 26 January.
Di Joint Admission Matriculation Board (Jamb) wey announce di informate assure prospective candidates say di registration exercise no go carry any wahala, as dem don put measures in place to ensure say candidates get ogbonge service.
For di Jamb bulletin wey di examination body issue on Monday, dem advise students to register for only Board-approved Computer Based Centres across di kontri.
Jamb registrar, Ishaq Oloyede also advise prospective candidates wey get biodata issues to correct am bifor dem go ahead wit di registration.
"Candidates wey get biodata issues, like dose wey relate to names, date of birth, or dose wey wish to correct dia data dey advised to do so wit di National Identity Management Commission (NIMC) bifor dem go ahead wit di registration," Oloyede tok.
Di registrar also warn say di board no go correct or use any data apart from di one wey NIMC generate.
Hia na wetin to know about di 2026 UTME and Direct Entry registration.
Who dey eligible for di 2026 UTME registration
Di minimum age for admission into Tertiary Institutions dis year (2025/2026 session) na sixteen (16) years, Jamb tok.
Di exam body explain say candidates must don reach age 16 bifor 30 September 2026.
"Candidates wey dey less dan16 years old by 30th September 2026 go undergo one intensive evaluation to determine dia eligibility for a waiver. Dat kain candidate go don score not less dan 80% for each of UTME/ALEVEL, PUTME, SSCE and for di exceptional candidate assessment."
JAMB add say dem go release di UTME results of di underage candidates only afta dem conclude di complete evaluation process.
Also to register for dis year UTME, candidates must don meet di minimum tolerable admission score into any higher institution of learning for di country.
- University - 150
- Colleges of Nursing - 140
- Polytechnics Monotechnic, Colleges of Agriculture and Colleges of Education - 100
- Innovation Enterprise Institutions (IEIs) - 100
Wen di registration go start and how long e go last
Di period of registration for UTME candidates including dose from foreign kontris go start from Monday, 26 January to Saturday, 28 February.
However, di sales of di UTME application document e-pin bin start on 19 January and go end on Thursday, 26 February.
Registration of di exercise go close on Saturday, 28 February.
For Direct Entry candidates, sales of di application documents and e-pin vending go start from Monday, 2 March and end on Saturday, 25 April.
Jamb add say di forms go only dey available for di board zonal and state offices.
Categories of e-pin
For di 2026 UTME, na three categories of e-pins dey available according to Jamb.
- Direct Entry e-pin
- UTME only witout mock e-pin
- UTME wit mock e-pin.
Di categories carry different charges.
Wen be UTME exam
Di 2026 UTME examination go start on Thursday, 16 April and end on Saturday, 25 April.
Di Mock UTME wey dey optional go hold on Saturday, 28 March.
Use of Microsoft or Digitech live camera
Professor Oloyede say for dis year exam, dem go deploy live camera to monitor live all di centres wey go participate for di 2026 UTME registration from Jamb Headquarters for Abuja.
"Any centre wey dia registration activities no fit dey viewed from di Jamb National Headquarters, Abuja, no go dey paid, and such registration fit dey invalidated," e tok.
Di registrar tok say di use of Microsoft or Digitech Live Cameras for UTME registration dey compulsory.
E stress say na only dis cameras dem go allow for capturing di second image during registration.
Oloyede say di measure na to minimise manipulation of fotos as dem detect during di 2025 registration exercise.