You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Who be Alex Honnold wey climb up 101-floor skyscraper without safety equipment?
- Author, Ottilie Mitchell
- Read am in 4 mins
American climber Alex Honnold don successfully climb up one Taiwan skyscraper without rope, harness or safety equipment.
Di building, named Taipei 101 sake of di number of im floors, tanda at 508m (1,667ft) of steel, glass and concrete and dem design am to resemble stick of bamboo.
Honnold dey popular as e be di first pesin to climb El Capitan, di vertical granite cliff for California Yosemite national park - also without ropes or safety gear.
Di climb originally suppose happun on Saturday but e dey delayed sake of di wet weather.
Im climb for Taiwan capital bin dey streamed live on Netflix, wey tok say delay go dey on di live feed should in case di worst happun.
Honnold bin complete di climb in one hour 31 minutes and e celebrate di achievement wit one word: "Sick."
Im time more dan halves di record of di only oda pesin to scale di tower.
Alain Robert, one Frenchman wey call imsef "Spiderman", bin make am to di top of Taipei 101 - at di time di world tallest building - in four hours. E do am wit ropes and a harness.
Taiwan Vice President Hsiao Bi-khim don congratulate Honnold on di ascent, e write on X: "I admit I go probably feel sick, too, barely able to watch."
Honnold wife hail am for di top of di building She bin express concern for di wind and heat as e dey climb.
But anoda distraction bin dey during im ascent.
As Honnold reach di 89th floor, fans begin hail am and dey wave to am, face to face but for di window as e hold on to di building.
Honnold and Netflix bin share video of di moment on Instagram, e show say di climber continue to dey clim wit no worry.
Honnold don make many extreme climbs during im career. One documentary about im ascent of di 3,000 foot (915m) El Capitan, titled Free Solo, bin win one Academy Award.