Call for Nnamdi Kanu release spark fresh protest between Anambra traders and govnor Soludo

Read am in 5 mins

Traders for Onitsha main market for Anambra State, Southeast Nigeria dey protest sake of how govment lock dia shops.

Onitsha, wey be di commercial capital of Anambra State for southeast Nigeria, trend for social media on Tuesday, as traders for di popular Onitsha Main Market para well-well for di state govment sake of di closure of di market for one week.

Govnor Chukwuma Soludo bin give order for di market shutdown for one week, sake of say di traders no gree to open dia shops on Monday.

According to am dem disobey di order wey Soludo bin give say di usual Monday sit-at-home situation for di state don end.

Di traders full for street dey chant songs wey dey support Nnamdi Kanu, leader of di Indigenous People of Biafra, wey Nigeria court sama life imprisonment.

Dem carry 'we no go gree' waka enta di Onitsha main market wit placards wey dem write different tins.

For one video wey don go viral, di protesters di songs wey dey hail dia alleged leader, Nnamdi Kanu.

On Monday 26 January, 2026 Anambra State govnor, Charles Chukwuma Soludo bin branch di Onitsha main market to check if treaders come market.

Oga Soludo bin dey monitor di Monday sit-at-home exercise wey govnors for di south-east dey try to end since but e neva really work.

'I go lock up shops for one week' - Soludo tok

For inside anoda video wey bin go viral on Monday, Govnor Charles Soludo bin dey para for traders wey still dey do sit-at-home as dem no open shop on Monday.

Im note say di popular Onitsha main market na di hub of business and trading for di east but now on notin dey happun for di market on Mondays.

Soludo say im bin dey do inspection and evriwia for Awka di state capital dey open, govment offices dey open, markets dey open, pipo dey go about dia business, but wen im reach Onitsha, come down to main market, di market wey bin be di largest and wey carry respect for West Africa no dey fully open.

Oga Soludo say im don waka for some places for di Onitsha main market and im see how some shops dey lock.

'I peep inside na few pipo I see here and there, okay, anybody for main market of markets wey neva open shop. I mean, for main market to dey shut down, I know say pipo bin don do dis sit-at home on Mondays for quite sometime now and as dem tok any abomination wey don last for one year don becom culture, no! Dis no go kontinu to happun for Anambra, and I go tell una say, you beta decide if you want to trade for hia or yiou fit go anoda place."

"For dis main market , if you no want make e open I go bring bulldozer come level am, and I dey serious anout am, i no dey joke."

"Going forward, any Monday wey any shop no open go dey locked for one week, all dis shops wey no open and dis market go dey locked up for di whole of dis week, market no go dey anywia for hia."

Di former CBN govnor say dem go di inspect di market evri week.

Court strike out Nnamdi Kanu motion to transfer am from Sokoto prison

Justice James Omotosho of di Federal High Court, Abuja, struck out ex-parte motion wey di convicted leader of di Indigenous People of Biafra (Ipob), Nnamdi Kanu file.

Di ex-parte motion na to transfer am from Sokoto prison.

For court on Tuesday, Kanu legal representative, Demdoo Asan tell court say dem wish to withdraw from di mata as dem cite irreconcilable issues.

Im explain say since di last adjourned date, im dey get constant phone communication wit di relatives of di applicant.

Di relatives no showface for di Legal Aid office to depose to di application, despite phone calls and promises wey dem bin make to appear.

Demdoo add say Kanu bin want to dictate di proceedings and control wetin counsel go tok for court.

"Im bin wan write down wetin I go tok for court. But, as officer of di court, I no go fit accept am in good faith," im tok.

Im tok say afta e do tok-tok wit im superiors, dem tok di same tin.

"As officers of di court, wen any mata come to us, we dey handle am as we fit; otherwise, di applicant fit find legal help elsewhere," Demdoo tok.

Im con invoke Order 50, Rule 1 of di Federal High Court Rules, wey im seek to formally withdraw from di matter.

For di ruling Justice Omotosho commend di counsel as im uphold im dignity and di court dignity too.

Im grant leave for Demdoo and di Legal Aid Council to withdraw from representing di defendant.

Di judge add say di motion dey incompetent. However, for di interest of justice and fairness, im direct di oda parties wey dey involved to dey served with notice.

Im say since di last court sitting on December 8, 2025, no proof of service dey before di court.

Justice Omotosho thereafter order make dem strike out di ex-parte motion for lack of competence.

How Monday sit-at-home start

Di sit at-home bin start for 2021 for di south-east region sake of di arrest of Nnamdi Kanu.

Since August 2021, dis protest dey go on evri Monday to tell govment to release di Ipob leader Nnamdi Kanu wey tok say e dey fight for di independence of Biafra.

Some pipo for eastern Nigeria bin don tire for di weekly sit-at- home.

Many oda cities for di region don resume normal activities on Mondays except Onitsha, wey dey host di ogbonge Main Market wey bin dey described as one of di biggest markets for West Africa.

Currently, Nnamdi kanu get for prison for Sokoto afta court for Nigeria find am guilty and Sentence Nnamdi Kanu to life imprisonment afta years of trial and long stay for Department of State custody.

On Tuesday court still troway Nnamdi Kanu request to transfer am comot from di Sokoto prison.