Guinness World Records say Ghanaian singer Afua Asantewaa singing marathon no dey successful

Wia dis foto come from, Afua Asantewaa Aduonum
Guinness World Records don tok say di Ghana media personality wey attempt di longest singing marathon for December 2023 no make successful.
Afua Asantewaa Aduonum don sing for 126 hours 52 minutes during di Christmas period for di kontri.
Di attempt don trend for days wia ogbonge musicians and celebrities for di kontri don go di venue to support am.
But afta two months, Guinness World Records don write for Twitter say im attempt fail.
For one response dem write say “unfortunately di singathon attempt neva dey successful, but we hope she go make anoda attempt soon".
“We don see how inspirational di attempt dey for im fans,” GWR add.
Di Guinness World Records also explain say dem refund di moni she pay for priority assessment last month.
“We don already dey check im evidence bifor Afua request priority service, na so we don refund im payment earlier dis month.”
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem add say dem wish Afua di best for future if im decide to do anoda record attempt.
Afta di attempt, di Ghana tourism authority don announce Afua as tourism ambassador wia im get oda national gigs.
Im also don sign as ambassador for some brands for di kontri for im effort.
How Afua dey sing di songs
Afua dey sing di songs alone for one soundproof booth for di akwaaba village.
Im no get instrumentalists or backing vocalists.
Im only get DJ wey dey play di instrumentals of di songs wey im dey sing am.
One of di guidelines for di singathon be say im only go fit repeat songs after four hours of singing.
Wey im no for go silent for any given song for more dan 30 seconds wia im no for sing more dan two minutes of each song.
Di singer also get only five-minute breaks after every one hour or im go take put togeda and take 20-minute break afta four hours.
So far, plenti of di top artistes don visit di akwaaba village.
Sarkodie, Shatta Wale, Efya, Becca, Kuami Eugene, John Dumelo, Lilwin and odas all don throw dia support behind Afua.












