Di Ghanaian wey dey attempt to break Guinness World Record longest singing marathon

One media personality and entrepreneur wey im name be Afua Asantewaa Aduonum dey try break one Guinness world record for di longest singing marathon.
Di reality TV show producer plan to take four days to break di existing record wey one Indian man don set for 2012.
Sunil Waghmare im record be 105 hours.
But di Ghana pesin say im wan break di record and set anoda one.
Na so im begin dey pursue wetin dem dey call "Afua Asantewaa Singathon."
Di first plan be say im go sing for four days and nine hours.
As at di time of dis report, she don sing 82 hours and get 48 plus hours to go.
Afua tok say for long time pipo for Ghana don dey say pesin no dey promote di kontri music.
End of Di one wey oda users dey read well well
Im add say apart from di tok tok, nobody dey take action, dat be why im wan use di singathon take promote local music.
“Dis na how I wan promote wanna music, sake of di industry for di neighbouring kontris be big, if we wan reach dat stage, den we for promote wanna songs,” Afua tok.
Di journalist also say im wan use di platform also promote dress wey dem do for Ghana.
Ahead of di singathon, dem send list of about one hundred songs wey im go sing for four days.
Di list get all genre of Ghana songs from di old and di young artistes.
Singing since Christmas eve
For Christmas eve 24 December, na so Afua start di singathon for one place di Ghana tourism authority create wey dem call am ‘akwaaba village’.
Since im start di singing, plenti pipo don dey pitch camp for dia to support am.
From di top musicians, to di actors, tiktok influencers, politicians and goment pipo, everybody don dey support am.
By di morning of 27 December, Afua don sing for 80 hours.
Im team tok say dem get more dan 48 hours more to break and den set new record.
Dem dey hope say im go fit do am, sake of im dey taya.

Pipo don dey fear say im no fit complete am sake of e don lose im voice but di team believe say Afua go do am. "Im be strong pesin wey im never dey give up.”
Pipo don spend dia Christmas and Boxing Day for di place to observe and support Afua for dis GWR attempt.
For some, na free Christmas concert be dat, for odas, e bi say dem wan ginger di lady make she carry on.
Na dat be wetin dey give am morale to still pursue am despite say di body don dey taya.
Di medical team den voice coach and oda team members don dey ensure say Afua dey good condition to continue to di finish line.
For now, di 27 December end date go vary.
Di team tok say “we go do more hours so say e go make up for some of di medical emergency breaks wey Afua don take during di singing.”
How Afua dey sing di songs
Afua dey sing di songs alone for one soundproof booth for di akwaaba village.
Im no get instrumentalists or backing vocalists.
Im only get DJ wey dey play di instrumentals of di songs wey im dey sing am.
One of di guidelines for di singathon be say im only go fit repeat songs after four hours of singing.
Wey im no for go silent for any given song for more dan 30 seconds wia im no for sing more dan two minutes of each song.
Di singer also get only five-minute breaks after every one hour or im go take put togeda and take 20-minute break afta four hours.
So far, plenti of di top artistes don visit di akwaaba village.
Sarkodie , Shatta Wale, Efya, Becca, Kuami Eugene, John Dumelo, Lilwin and odas all don throw dia support behind Afua.

Di Ghana tourism authority say “dis singathon dey take di world attention come Ghana, at a time wey pipo from di diaspora dey return home for Christmas.”
“Dis be great opportunity to market destination Ghana well well. For now, di world dey watch we,” di CEO Akwasi Agyemang don tok.
Di tourism authority say dem go support am all through till di end.
For social media, pipo don dey jump on di hashtag #AfuaAsantewaaMarathon to show dia support to di mama of two, wey im dey trend for Ghana.
At least three TV stations don dey carry am live since di singathon start.
As at di morning of 27 December wen Afua take one long break, im husband carry placard wey im take support am.
Dem write say “More strength, Afua.”
Throughout di last four days, Afua im papa also don dey di event grounds dey cheer am on.











