‘I admire Alan for achieving dis great feat’ – Hilda Baci hail new GWR wey dethrone her

Wia dis foto come from, @alan.kyojin.stewhouse/Instagram
Chef Hilda Baci don congratulate Irish Chef, Alan Fisher, wey dethrone am as di Guinness World Record holder for di longest cooking marathon by an individual.
Alan become di new record holder afta im cook for 119 hours and 57 minutes for im restaurant for Japan.
Hilda Baci on X tok say 119hrs 57mins na huge achievement, and she “wish am all di best as di new world record holder!”
Alan Fisher(Ireland) wey be chef for one Japan restaurant, break two cooking-related Guinness World Records titles, GWR tok.
First, e bin claim di longest cooking marathon (individual) afta e clock in time of 119 hours 57 minutes. Dat na more dan 24 hours longer dan di previous record wey Nigerian chef Hilda Baci hold.
Bifor dis cooking marathon, Alan bin claim di longest baking marathon (individual), wit time of 47 hours 21 minutes. Di previous record holder be Wendy Sandner (USA) wit time of 31 hours 16 minutes.
According to GWR, wetin dey more impressive be say Alan take both attempts back to back, e mean say e bin dey work for di kitchen for over 160 hours wit just over one day of rest in between.

Wia dis foto come from, @Hildabacicooks/X
Recreating Irish culture for Japan

Wia dis foto come from, GWR/BBC
Guinness World Records tell di tori of how di new record holder Alan bin try look for wetin to challenge am di year of im graduation from Dublin City University for 2008.
End of Di one wey oda users dey read well well
Den e bin go through one overseas graduate programme, wey dey introduce Irish graduates to companies for Asia, Alan den gbab one job offer for one company for Tokyo.
About six years later, Alan don establish imself wella for Tokyo, and also meet im wife (and to-be business partner). But sometin no feel right for am.
"After di wedding, to say bye-bye to 30 friends and family wey bin come over, I remember one feeling trapped, thinking to myself, 'Na dis be am? Dis na my life now, to get kids and work for di same company?' Na time for di next challenge."
So for August 2014, Alan bin take di leap of faith and decide to start im own business; e no dey difficult for am to pick Irish food and culture as di main themes of di business.
Alan restaurant Kyojin Stewhouse focuse on di mainstays of Irish households: stews, soups, homemade breads, and potatoes. According to Alan, customers no dey only feel like dem dey Ireland, but also feel as if dem dey dia home.

Wia dis foto come from, GWR
Breaking records

Wia dis foto come from, GWR
Alan bin hear about di longest cooking marathon record for March while e bin dey participate for di "I Love Ireland" festival for Tokyo. During dis festival, Alan bin stand inside one rented kitchen car and stay overnight twice.
During one break, e bin search on di internet to find out say di record for di time bin hold for Lata Tondon (India) wit time of 87 hours 45 minutes. Den for May, Alan realize say Hilda Baci don extend di record to 93 hours and 11 minutes.
Meanwhile, Alan still dey try recover from di difficulties during di COVID-19 pandemic.
"Wen Omicron spread, one sudden dining out advisory from di local goment mean say I don lost all my reservations for di month of July 2022 and need to take out pandemic support loan just to pay bills," e tok.
"I dey broke and heartbroken. To need work so hard for so long, to give up your own savings, your own salary and den still need loan simply to stay for business wit no guarantee say tins go recover. Dat one na tough pill to swallow."
Despite say authorities ease restrictions, Alan bin kontinu to carry dis negative energy as e kontinu wit im work. "Lata and Hilda achievements bin serve as inspiration," e tok.
In order to fit channel im frustration and negativity into sometin positive, Alan den decide to take on di record-breaking journey imself.
Di record attempt prove to dey extremely challenging, even during di preparation phase.
In particular, Alan need to make food distribution plan so dat wastage of food wey e go cook no go shelle.
"Everytin must dey for human to chop. My attempt go only dey successful if di pipo of Matsue get behind wetin I dey do and show up to support di challenge."
To add, Alan need to film di record of im attempt for evidence. E dey thankful say TSK, di local TV provider, bin come to help. "I sabi say dey bin need to allocate staff and resources to support dis challenge. Dis one cost time and moni and definitely no lost on me. I dey really grateful to dem."

Wia dis foto come from, GWR

Wia dis foto come from, GWR

Wia dis foto come from, GWR
Afta nine days of baking and cooking, Alan don make 357 kg worth of soda bread and 590 kg worth of dishes (3,360 portions wey get 32 recipes).
But e all worth am wen e receive im two world record certificates, Guiness World Records tok.













