Poland shoot down Russian drones wey enta dia airspace

Wia dis foto come from, Reuters
Dem don close down four airports for Poland, including dia largest one wey dey Warsaw, afta tori come say Russian drones enter dia airspace, according to di Reuters news agency.
Two airports for di capital Warsaw – di major hub Chopin Airport and Warsaw Modlin Airport – dey closed. Also suspended na Rzeszów-Jasionka Airport – di air hub wey close to Ukraine pass - and Lublin Airport according to one notice dem post to di US Federal Aviation Administration website.
Dis come as Nato and Polish fighter jets were scramble as Russia launched anoda massive attack on Ukrainian regions close to di border wit Poland.
Di overnight Russian attack bin involve 415 drones, one ballistic and 42 cruise missiles, according to di Ukrainian air force for dia statement.
Out of all, dem stop 386 drones and 27 cruise missiles.
"At least eight enemy UAVs cross di Ukrainian state border fly go Poland direction," di air force say.
Poland armed forces say dia kontri airspace dey "repeatedly violated by drone-type objects" during Russia strikes on western Ukraine.
Dem say some of dis objects don dey down.
According to di armed forces, dis dey mark di first time di Nato kontri don directly engage Russian assets for dia airspace since Moscow full-scale invasion of Ukraine for 2022
Military operation don end afta Polish and Nato aircraft dey deployed, as Poland Prime Minister Donald Tusk don call emergency meeting.
Di Prime Minister Tusk say di Polish military bin record 19 drone incursions for di kontri airspace overnight.
Wen e dey speak to di Polish parliament, Tusk say three or about four drones dey shot down by Polish and Nato aircraft wey dey deal wit di threat.
Tusk say significant number of di drones fly into di kontri from Belarus.
Di last drone wey dem shoot donw na for 06:45 local time (05.45 BST), di PM say.
Polish police say dem don find damaged drone for Czosnówka, village for eastern Poland, about 40km (25 miles) from di border wit Belarus for 5:40 am (4:40 BST).
"We don notify di appropriate services. Procedures dey go on," police from di Lublin region post for X.
'Dangerous for Europe' - Zelensky
Ukraine President Zelensky, call di Russian drones wey enta Polish airspace as " extremely dangerous precedent for Europe".
"Di Russians gatz feel di consequences. Russia gatz feel say di war no fit expand and e gatz end," e say.
Zelenskyy say di pause in sanctions don go on far too long and Ukraine ally gatz respond.
We dey update dis tori...









