Fatima Bosch of Mexico wey waka comot on organisers win Miss Universe
- Author, Joel Guinto
- Role, in Singapore
- Author, Panisa Aemocha
- Role, in Bangkok
- Read am in 7 mins
Dem don crown Miss Mexico Fatima Bosch as Miss Universe for di ceremony in Bangkok, marking di end of di pageant season wey get plenty scandal.
Di 25-year-old contestant bin waka comot from one event earlier for November afta Thai official publicly insult her in front of dozens of contestants and threaten to disqualify pipo wey support her.
Weeks later afta di dramatic event, two judges resign, one of dem accuse organisers of rigging di competition.
Di dey come as one of di world longest-running beauty pageants face kwesions of ova im relevancy as audience dey reduce.
Di contest latest result add to di controversy, wit news of Miss Mexico win instantly dividing opinion online.
Many Mexicans celebrate her victory, as odas praise her for her walkout.
But some dey also wonder if organisers give her di crown to make up for di earlier scandal.
Miss Thailand Praveenar Singh place first runner up while Miss Venezuela Stephany Abasali place third, den Miss Philippines Ma Ahtisa Manalo and Miss Cote d'Ivoire Olivia Yace.

Wia dis foto come from, Getty Images
Drama in Bangkok
Tins take dramatic turn for di pre-pageant ceremony early dis month, wen Thai media mogul and pageant organiser Oga Nawat Itsaragrasil tell Ms Bosch in front of dozens of contestants make she comot becos she no post promotional content.
Wen she object, Nawat call security and threaten to disqualify pipo wey support her. Ms Bosch den comot from di room and odas join her in solidarity, dis move make headlines around di world.
Di Miss Universe Organization condemn Nawat behaviour as "malicious" and oga Rocha from Mexico, tell im Thai business partner to make im just "stop".
Mexican President Claudia Sheinbaum praise Ms Bosch say she be "example of how we women suppose speak out" in di face of aggression.
During Friday finals, Mr Nawat post fotos from di audience on im Instagram stories but dem no see am ontop di stage.
Afta Ms Bosch crowning, e post one one-line statement in Thai ontop im social media accounts, e tok say: "A billion words wey we no fit tok".
E also tell tori pipo: "As for di outcome, we go leave am to di viewers at home to judge... pipo everywia fit make dia own assessment."
On social media, some fans tok say di backstage drama help Ms Bosch win di crown, dis na Mexico fourth crown.
"Next year, whoever waka comot go win," one comment read, while anoda tok say: "Dem crown her to make up for injustice earlier to save Miss Universe!"
Di BBC don contact di Miss Universe Organization for comment.
Ontop dia social media accounts, di organisation praise Bosch, dem tok say "her grace, strength, and radiant spirit capture di hearts of di world".
One week afta di walkout controversy, two judges resign as one of dem accuse organisers say dem rig di selection process.
Lebanese-French musician Omar Harfouch, announce im resignation from di eight-member jury on Instagram, e allege say dem get one "impromptu jury" wey don already pre-select finalists ahead of di final on Friday.
Hours later, former French football star Claude Makelele also announce say im go pull out, citing "unforeseen personal reasons".
Di Miss Universe Organization reject oga Harfouch claims, dem tok say " dem neva authorise external group to evaluate delegates or select finalists".
On Friday, minutes afta dem annouce Ms Bosch win, Harfouch post one statement online wia im repeat im allegations of rigging.
Inside one separate incident, during di preliminary evening gown round on Wednesday night, Miss Jamaica accidentally fall onstage and den dem rush her out wit stretcher.
Clips of di incident wey dem share on social media. Organisers later tok say dem hospitalise am but she no break her bones, she dey "under good care".
Turbulence for di top
Di recent controversies, analysts tok say, underscore di cultural and strategic differences between Miss Universe Thai and Mexican owners.
Di pageant event organiser na Mr Nawat, di founder and owner of Miss Grand International, smaller Thai-based contest, e dey loud for dia loud social media presence.
Mr Nawat hold di licence to host dis year Miss Universe pageant, while Mexico businessman Raul Rocha dey run di Miss Universe Organization.
Thai transgender media mogul Anne Jakrajutatip bin own di event, e acquire di pageant from US entertainment company Endeavor in 2022.
She change di rules to allow inclusivity, allowing transgender women, women wey don marry and women wit children to participate. She also end di age limit for contestants.
As audiences dey reduce ova di years, she monetise di Miss Universe brand, stamping am on merchandise such as bottled water and bags.
She resign as CEO of JKN just bifor dis year pre-pageant events and den Guatemalan diplomat Mario Bucaro replace am.

Wia dis foto come from, Getty Images
Bifor she resign, Ms Jakrajutatip bring in Mr Rocha from Mexico as business partner and later ask Mr Nawat to organise di 2025 pageant.
Na "very rocky transition" for di pageant leadership, Dani Walker, American beauty queen and pageant coach tell di BBC. She tok say na important leadership roles dey between leaders in Bangkok and Mexico.
Di leadership structure dey much clearer wen Endeavor bin dey run di pageant bifor Donald Trump, she tok.
"For fans and outsiders, e dey very confusing. No one know who di real leaders be or who to ask wen dem get questions, and dat dey very damaging to di brand," Paula Shugart, tell di BBC, e don serve as Miss Universe Organization president under di previous two owners.
Thitiphong Duangkhong, scholar of women and Latin American studies and expert for beauty pageants, e tok say pipo wey dey behind di pageant suppose dey aware of dia cultural differences.
"For our kontri, we use di Thai language to communicate wit our fellow Thais. We understand di social context, we understand social structure, we understand di inequality of power for society, and we dey constantly use am to negotiate wit di Thai language," e tell di BBC.
Oga Thitiphong tell Ms Jakrajutatip as transwoman e fit no sit well wit some Latin American fan wey don subscribe to macho culture.
"Pipo dey tok say women who wey no be women suddenly dey buy pageant, pageant wey suppose to be about women entertainment. Wetin dey go hapun?"
Wetin be di next tin for Miss Universe?
Di crowning of di new Miss Universe, di 74th since 1952, signal di resolve of organisation wey remain relevant and evolve from once in a year television program to media brand wey don dey ready for TikTok.
For years, audiences for di Miss Universe broadcast don reduce as fans shift to social media.
On TikTok and Instagram, former titleholders, even runners up, now maintain accounts wit millions of followers, transforming dem into influencers.
Na dis e-commerce Nawat want Miss Universe queens to embrace like Miss Grand International - selling merchandise for live broadcasts
But on di Latin American side, beauty queens still glamourised television celebrities.
Miss Universe reality show even include di winner - Dominican crowned Miss Universe Latina - she competed in di main pageant for Bangkok.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di contest still dey very popular for Latin America and South East Asia, wia pageant crowns don become way out of poverty or express pass for girls wey dream of becoming celebrity.
But e still dey face questions ova im relevancy and constant criticism say e dey sexually objectify women.
Organisers don make accommodations in recent years. While di majority of contestants wear two piece bikinis for di 2025 contest swimsuit round, pipo from conservative kontris wear full-body coverings.
"Of course, no be for everyone, and we go always get pipo wey go disagree. But as long as di core values dey intact, I think pageants go always have role to play in society," Ms Shugart, di former president tok.
She tok say empowering women suppose be di organisation core.
"Miss Universe na notin if yo no dey empower di women wey dey compete."













