Why Miss Universe contestants waka comot event during 2025 competition

Wetin we call dis Video, Watch: Miss Universe contestants waka comot one briefing afta organiser call Miss Mexico 'dumbhead'.
    • Author, Ian Aikman
  • Read am in 4 mins

Plenty contestants waka comot one Miss Universe event afta one official from di host nation Thailand publicly yab Miss Mexico for one tense confrontation.

For one pre-pageant ceremony, Miss Universe Thailand director Nawat Itsaragrisil blast Fatima Bosch for front of dozens of contestants bicos dem fail to post promotional content.

Wen she protest, Oga Nawat call security and threaten to disqualify those wey dey support her.

Ms Bosch later waka comot di room and odas join her in solidarity. Di video of di incident wey dem stream live don go viral for social media.

Di Miss Universe Organisation (MUO) don condemn Oga Nawat "malicious" behaviour, for which e don since apologise.

Fatima Bosch for one sparkly dress and her Miss Mexico sash on stage for di pageant

Wia dis foto come from, RUNGROJ YONGRIT/EPA/Shutterstock

Wetin we call dis foto, Fatima Bosch tok say Nawat Itsaragrisil bin "no dey respectful" for di pre-pageant ceremony on Tuesday

Di Miss Universe contestants, wey be di winners of national pageants for dia home countries, bin attend di Tuesday event for dia sashes and gowns.

Pipo fit hear as some of dem dey shout for Oga Nawat for di video, afta e raise im voice to yab Ms Bosch and repeatedly tell her to stop talking.

As many of dem stand to show support, Oga Nawat say: "Make anyone wey wan continue di contest, sit down. If you step out, di rest of di girls continue."

Despite dis, majority of di women for di video be like say dem stand, and most of dem waka go di door.

Afta she comot di event on Tuesday, Ms Bosch tell tori pipo say di 60-year-old executive bin no dey "respectful" and she say e call her "dumb".

Oga Nawat no fight am, e claim say dem misunderstand im words.

Nawat Itsaragrisil smile for inside one tuxedo on di red carpet

Wia dis foto come from, RUNGROJ YONGRIT/EPA/Shutterstock

Wetin we call dis foto, Thai businessman and media personality Nawat Itsaragrisil don tok sorry for di incident

Plenty tori report say e call di 25-year-old "dumbhead". But for one press conference, e later claim say wetin im tok na say she cause "damage".

Im conduct bin make di MUO rebuke am, dem send delegation of international executives to take ova di running of di competition.

For inside one video statement, MUO President Raul Rocha say Mr Nawat don "forget di true meaning of wetin e mean to be a genuine host".

E tok say di Thai official bin "humiliate, insult and show lack of respect" to Ms Bosch, and e commit "serious abuse by calling security to intimidate a defenceless woman".

Mr Nawat participation for di pageant go dey limited "as much as possible" or eliminated entirely, e tok, e add say di MUO go take "legal actions" against am.

"I wish to repeat am say Miss Universe na empowerment platform for women so dat dia voices go dey heard for di world," Mr Rocha tok.

Among dos wey waka comot on Tuesday na di reigning Miss Universe Victoria Kjaer Theilvig of Denmark.

"Dis na about women rights," she tok as she comot di event. "Dis no be how dem suppose handle situations. To trash anoda girl dey beyond disrespectful... Dat na why I take coat and I dey walk out."

Ms Bosch later tok for one interview: "I just want make my country know, I no dey afraid to make my voice heard. E dey here stronger dan ever. I get purpose. I get tins to say.

"We dey di 21st century. I no be doll baby dem go make up, style and change my clothes," she add.

"I come here to be a voice for all di women and all di girls wey dey fight for causes and to tell my country say, I dey completely committed to dat."

Video of Mr Nawat don make fans of di pageant para, as many heavily condemn im actions and hail Ms Bosch response.

For one social media video statement, Mr Nawat tok say: "If anyone feel bad, uncomfortable, or affected, I apologise to everyone. I especially apologise to di girls wey dey present, around 75 of dem."

Di Miss Universe competition dey go on despite dis controversy, as contestants take part for one welcome event for Bangkok on Wednesday.

Dem go crown di winner di new Miss Universe on 21 November.