'We get call say e shoot imsef just 30 minutes afta my papa call us' - Family of officer wey dem link to bandits

Di late Abdullahi Isah wear cream colour log sleeve shirt wey get buttons and broen design. E barb gorimakpa hair and dey look sideways as e keep hand ontop white car wey resemble Hilux

Wia dis foto come from, Abdullahi Isah family

Wetin we call dis foto, Foto of di late Deputy Superintendent of Police for Niger State, Abdullahi Isah
    • Author, Tamara Ebiwei
    • Reporting from, Abuja, Nigeria
  • Read am in 5 mins

"We don marry for about 30 years, and I no sabi am wit any ugly character. But wen dem put allegation for your head e hard to come out."

Dis na wetin Rukaya Isah, di widow of di late Deputy Superintendent of Police [DSP], Abdullahi Isah tok as she dey mourn her late husband wey allegedly take im own life on Wednesday sake of accuse.

Tori bin dey fly upandan say di late DSP shoot imsef sake of allegation say e dey supply bandits for Niger State, north central Nigeria wit weapons.

Tok-tok pesin for di Niger State Police Command, Wasiu Abiodun confam di tori to BBC News Pidgin on Friday.

Im tok say na on December 16, 2025 at about 2.30pm, na im DSP Abdullahi Isah wey dey attached to Minna, wey dem bin initially arrest shoot imsef.

"Dem bin initially arrest am on 15 December sake of suspicion say e dey involved wit illegal dealings of ammunition.

Dem bin carry am go im office for routine arms audit, and unfortunately while di audit process bin dey go on, di said officer shoot imsef for head wit one pistol wey im bin pick within di office and e die on di spot."

Di Police Public Relations Officer add say dem also arrest di policemen wey dem bin detail along for di audit and investigation activities for "negligence in line of duty", sake of say dem allow dat kain situation to occur and "investigation dey in progress." im tok.

'My husband no fit commit dis kain crime'

Mrs Rukaya Isah dey veri sad say her husband lose im life like dis, but she tok say as muslim wey she be, she believe say na di act of God.

She tell BBC Pidgin say her husband na good man wey dey even advice pipo to stop to drink alcohol and pipo wey sabi her husband like am well-well.

"Between me and my creator I no tink say my husband dey capable to do dat kain act, im no get dat kain character, im no dey even drink or smoke. Even pipo wey dey around am fit testify to im good character, however wen dem don place allegation on you, e dey difficult to comeout.

Mrs Isah say she and her family dey beg govment to release her husband deadibody so dat dem go fit bury am according to islamic rites. She add say dem don leave evritin for God.

Mrs Isah wey bin lose two children out of her nine children dey pain thru pain sake of her husband death.

'Im bin call us say im go soon come back, in less dan 30 minutes we receive call say im shoot imsef'

Tears full Mr Isah daughter, Ubaidat Isah eyes as she tell BBC Pidgin who her papa be and her last memory of am.

"We bin dey house wen im bin call us, im tell us say make we bring im union form and Automated Teller Machine[ATM] card for am, say im go soon come back. In less dan 30 minutes we receive call say im shoot imsef and I believe say im no shoot imsef"

According to her, wetin she want na make dem release di deadibody say dat dem fit bury am make in rest in peace as dem no know exactly wetin hapun.

"Im no dey alive to defend imsef we leave am to God, we believe say God go judge us and na only God know di truth of di matter and wetin hapun for there. We no know if im really do am or na dem do am. I trust my papa, im no fit even hurt ant, tok of wetin dem accuse am of and say im shoot imsef."

One of dia neibour Sylvester Saimasu say im dey live near dem since 2019.

"I dey veri surprised wen I hear wetin hapun but wetin I fit tok, Actually I no sabi am like dat but I no know."

Profile of late DSP Abdullahi Isahi

According to di family, late Deputy Superintendent of Police, Abdullahi Isah die at di age of 57.

Im from Ganjua Local Govment Area of Bauchi State, north eastern, Nigeria.

Im join di Police Service for 1991 and rise to di rank of Deputy Superintendent afta dem promote am two years ago [2023].

Na next year, 2026 im suppose retire from service.

According to di The Sun, until im die, di late DSP Isah Abdullahi na di head of di armoury of Mopol 12, wey dey for di premises of B Division of di state police command, Paikoro Road, Minna, Niger State.

Kasala state for di DSP wen one team of detectives from Abuja bin visit Mopol 12 for di annual routine auditing of arms and ammunition.

Di audit pipo kon discover say some ammunitions dey either dey miss or im no fit accounted for dem.

Di Sun report say di preliminary findings show say 13 AK-47 rifles and over 2000 rounds of ammunition dey miss.

Accoprding to di tori Mopol 12 armoury get different kain of weapons but only di AK-47 section na im dem no audit bifor di incident hapun.

Insecurity for Nigeria

Insecurity dey face insecurity issues from kidnapping, banditry and oda crimes.

Dis dey give di Nigeria govment headache as dem dey try to reduce criminal activities for di West African nation.

To show say govment serious, President Bola Tinubu appoint new Defence Minister sharp-sharp afta di former one retire on health grounds.

Im wit oda security experts gatz tackle dis issue sharp-sharp.

Nigerian dey expect see dem go begin see results very soon.