Nigeria Airforce crew wey dem bin detain for Burkina Faso don regain freedom, kontinue dia journey to Portugal

Wia dis foto come from, Nigeria Air Force
Di Nigeria Air Force say di military aircraft and crew wey Burkina Faso authorities bin arrest afta dem land for di kontri witout permission, don regain freedom and kontinu dia journey to Portugal.
NAF tok-tok pesin Ehimen Ejodame tok say di plane comot from Bobo-Dioulasso on Friday evening and e arrive safely for Accra, Ghana and na from dia e go comot to Portugal via Banjul and Casablanca, wia di plane bin dey scheduled to undergo routine depot maintenance.
"Di Nigerian Air Force appreciate di concern and support expressed by members of Di public and dey assure Nigerians say all personnel remain safe, di aircraft dey serviceable, and di Service go continue to operate to di highest standards of safety and professionalism," Ejodame tok for di statement.
Di military aircraft NAF C-130 bin land for Burkina Faso on Monday, 8 December, without permission, but di Nigeria Airforce authorities say di plane bin develop in-flight technical wahala and dat na why dem land for di nearest airport according to aviation regulations.
Howeva, di Alliance of Sahel States wia Burkina Faso, Mali and Niger belong to, para for di development and describe am as "violation of dia airspace and di sovereignty of dia member state".
Di Burkinabe authorities hold di 11 crew membas for di plane unda arrest until di Nigeria Minister of Foreign Affairs, Yusuf Tuggar, carry some oda top govment pipo go Burkina Faso to meet wit dia Military President Ibrahima Traore to apologise to am for wetin happun.
Tuggar explain say "irregularities bin dey di documents, particularly concerning di overflight authorizations for Burkina Faso. Dis dey regrettable and we apologise for dis unfortunate incident."
Dis incident, according to some foreign affairs sabi pipo, show say some West Africa kontris no trust diasef again.
Remember say Burkina Faso, Mali and Niger bin form di AES, wen dem comot from ECOWAS earlier dis year.
Dia exit bin scata established regional security cooperation - particularly witin di multinational joint task forces wey bin dey fight against insurgency and terrorism for di Sahel and Lake Chad region.
For dis volatile environment – wey be say na frequent coups, insurgency, and cross-border instability - airspace and border control don bicom especially sensitive issues.
Di AES member states now dey treat unauthorised military overflights as potential threats, not accidents.
Also, just bifor di landing incident, Nigeria bin deploy jets and troops go di neighbouring Benin Republic to help suppress one mutiny – wey signal Nigeria increased regional military activity.
Dat move bin also draw different reactions across di region.








