Highlights from Joe Biden speech afta im party lose to Donald Trump

US President Joe Biden addressing Americans

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 4 mins

President Biden don address American citizens afta Democrat lose di presidential election to Republican candidate former president Donald Trump.

Dis na Biden first televised address since im party lost.

President Biden enta di Rose Garden outside di White House, wia e deliver im speech.

Biden say im don follow Kamala Harris tok, and im tok say she don dey supportive as "a partner and a public servant".

US President Joe Biden addresses Americans

Wia dis foto come from, Getty Images

E compliment Harris' "inspiring" campaign, praise her "backbone", and say make she dey proud of her work.

Biden tok say for some pipo na time for victory, for odas na time of loss.

"One kontri choose one or di oda. We accept di choice di kontri make," im tok.

"You no fit love your kontri only wen you win. You no fit love your neighbour only wen you agree,"

During im address, Biden tok say for ova 200 years, di US don carry out di "greatest experiment of self goment in di history of di world," wia di pipo vote and choose dia own leaders and do am peacefully, "wia di will of di pipo dey always prevail".

E say e don follow President-elect Donald Trump tok and congratulate am on im victory and to help am wit orderly transition of power.

Highlights from di president speech

Peaceful transfer of power: Biden tok say im go peacefully transfer power on 20 January, and add say: "I go do my duty as president."

E tell Americans say make evri one respect all election workers, and tank dem.

"Many be volunteers wey dey do am out of love for kontri," e tok .

Giving up dey unforgivable: Biden say “ dis na historic presidency."

"We dey leave behind di strongest economy in di world," e tok.

"Now we get 74 days to finish di term, our term, make we let evri day count", Biden tok and add say dis na dia responsibility as goment.

"Set backs dey unavoidable but giving up dey unforgivable."

Biden tok say pipo all get knocked down, but di "measure of our character" na how we get back up.

"We lose dis battle, di America of your dreams na calling for you to get back up."

We gatz keep di faith: Biden tell im supporters ' to keep di faith'. E say, "We go dey okay, but we need to stay engaged."

E say e dey proud of di cabinet wey work wit am and im team.

"God bless you all and America," e tok.

Biden later blow kiss to di crowd - wit im granddaughter in di front row.

Strongest economy in di world: Biden tok say dem dey leave behind di strongest economy in di world.

"We dey leave behind di strongest economy in di world. I know say e still dey pain some pipo. But tins dey beta dan we find dem."

Di president no take question as im walk away afta im speech.