Emmanuel Macron name new France prime minister to end political instability

François Bayrou and Emmanuel macron

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 4 mins

President Emmanuel Macron don name a centrist leader François Bayrou as di new next prime minister of France.

Dis na in a bid to end plenti months of political turmoil wey don cause kasala for di kontri.

Bayrou wey be Macron padi na mayor from di southwest and e dey lead di MoDem party.

Ahead of di announcement, di two of dem (Macron and Bayrou) spend almost two hours to tok.

Di president now get di task to ensure say Bayrou last longer dan im predecessor.

Bayrou na di fourth France prime minister for 2024.

Dis new announcement dey come afta French govment drive out Prime Minister Michel Barnier for a no-confidence vote.

Just three months wey President Emmanuel Macron appoint Barnier, di MPs vote in support of di motion against Barnier.

Opposition parties bin table di motion afta di prime minister wey be former Brexit negotiator controversially use special powers to force im budget through witout a vote.

Dis dey mark di first time di kontri govment collapse in a no-confidence vote since 1962.

Di development bin continue France political instability afta di snap elections for summer lead to no single group wey get majority in parliament.

Di parliament members bin dey required to either vote yes or no as na only 288 votes dem need for dem to pass di motion. But na total of 331 votes bin dey in support of di motion.

Macron don dey half-way through im second term as president and Bayrou go be im fourth prime minister dis year.

French politics dey enta deadlock since wen Macron fallout during di parliamentary elections during dis summer.

Who be François Bayrou?

Bayrou na close friend to President Macron since bifor Macron first election win for 2017.

Indeed Bayrou decision na to stand aside as a candidate dat year - and rally behind Macron campaign.

A well-known figure on di political stage for more dan 40 years, Bayrou - wey be 73 years old bin run di Modem party, wey don get 36 deputies, since di formation for 2007.

E begin from di Christian Democrat tradition of post-war politics.

Bayrou, wey be teacher of classical languages for im 20s bin serve as education minister from 1993 to 1997. But dat na im last meaningful experience of govment.

Very briefly for 2017, e become Macron justice minister, but step down afta dem accuse am in a party funding scandal. But dem eventually clear am of wrongdoing.

Bayrou na observant Catholic wit six children, and im political base na di Pyrenean city of Pau wia e bin mayor since 2014.

E dey speak di local Bearnese language and na strong believer in decentralisation.

Bayrou bin run for di presidency three times, as standard-bearer of di centre. E dey closest to victory for 2007, wen e come third wit nearly 19% of di vote.

E vex di future winner Nicolas Sarkozy by coming out in support of di Socialist candidate Ségolène Royal.

Bayrou go dey expected to calm di political situation for France and di parliament.