French govment collapse for no-confidence vote - wetin be di next tin for France Prime Minister Michel Barnier

Wia dis foto come from, Reuters
Di French govment don collapse afta dem drive out Prime Minister Michel Barnier for a no-confidence vote.
Just three months wey President Emmanuel Macron appoint am, di MPs vote in support of di motion against Barnier.
Opposition parties bin table di motion afta di Prime Minister wey be former Brexit negotiator controversially use special powers to force im budget through witout a vote.
Dis dey mark di first time di kontri govment collapse in a no-confidence vote since 1962.
Di development go kontinu France political instability, afta di snap elections for summer lead to no single group wey get majority in parliament.
Di parliament members bin dey required to either vote yes or comot from Wednesday vote as na only 288 votes dem need for dem to pass di motion.
But na total of 331 votes bin dey in support of di motion.
Wetin go happun next to Michel Barnier?
Prime Minister Barnier now dey expected to present di resignation of im govment.
Also, di budget wey trigger im downfall don end.
Howeva, e dey likely to stay on as caretaker prime minister while Macron go choose a successor.
Both di left and far right don table motions of no-confidence afta Barnier push through reforms to social security wen e invoke presidential decree on Monday, even though e fail to win enof support for di measures.
Di left-wing alliance New Popular Front (NFP) wey win di most seats for di parliamentary elections don previously criticise Macron decision to appoint a centrist Barnier as prime minister ova im own candidate.
Alongside di far-right National Rally (RN), dem see Barnier budget as unacceptable as it also included €60bn (£49bn) in deficit reduction.
Marine Le Pen, di RN leader say di budget dey "toxic for di French".
Ahead of di vote, Barnier tell di National Assembly say voting him out of office no go not solve di kontri financial problems.
"We don reach a moment of truth, of responsibility. We need to look at di realities of our debt, no be pleasure say I propose difficult measures."
For one interview wit French broadcaster TF1 on Wednesday, Le Pen say e no get "oda solution" dan to remove Barnier.
Wen asked about di French president prospects, she reply: "I no dey ask for di resignation of Emmanuel Macron."
Howeva, Le Pen add say "if we no respect di voice of voters and show respect for political forces and respect for elections", den pressure on di president go dey "obviously stronger and stronger".
Wetin president Emmanuel Macron go do?
Emmanuel Macron wey don return to France following a state visit to Saudi Arabia, go give a televised speech to di nation on Thursday evening.
E no dey directly affected by di result of di vote, as France votes for im president separately from di govment.
Macron don tok alreadi say im no go resign wateva di outcome of Wednesday vote be.
E dey expected to name a new prime minister sharparly to avoid di embarrassment of a non-existent govment - not least becos di US President-elect Donald Trump dey due to go Paris dis weekend for di reopening of di Notre-Dame cathedral.
No new parliamentary elections fit hold until July, so di current deadlock for di Assembly wia no group fit hope to get a working majority go kontinu.









